Donald Trump say e dey “very angry, pissed off” with Vladimir Putin over recent comments about Ukraine President Volodymyr Zelensky.
Trump bin dey react to comments from Putin on Friday about di need for a new, transitional government for Ukraine.
Di US president say e go put “secondary tariffs on oil, on all oil coming out of Russia” if e tink say Moscow na im get di blame for di failure to to reach a ceasefire.
Na inside phone call to NBC News journalist Kristen Welker on Sunday, di US president say e dey “very angry” with Putin, and threaten to impose extra tariffs on countries buying Russian oil if dem no reach deal for Ukraine.
“You fit say I dey very angry, pissed off, wen… Putin start to dey get into Zelensky credibility, because dat no dey go in di right location,” Trump tok.
E bin dey respond to comments Putin make on Friday, wey suggest say Zelensky no get di legitimacy to conduct peace talks, wit di Russian leader wey dey float di idea of placing Ukraine under UN control.
Di US president say: “New leadership mean say you no go get deal for a long time.”
“If Russia and I no fit make a deal on stopping di bloodshed for Ukraine, and if I tink say na Russia fault – wey e fit no be… I go put secondary tariffs… on all oil coming out of Russia,” Trump tok according to reports.
Dis na a shift for Trump. But di US president later be like say e soften im stance, e tell reporters aboard Air Force One say e no tink say Putin go “go back on im word”.
Trump tell reporters say e and Putin bin dey “always get along well” and say e no tink say Putin go “go back on im word”.
Trump repeat say e no “dey happy” with recent comments Putin don make but add: “I tink e go dey good.”
Wetin Putin bin tok
Donald Trump comments on Sunday – say e dey “very angry” with Vladimir Putin – na a response to di Russian president comments on Friday, fo di far north-western Russian city of Murmansk.
Dia, Vladimir Putin suggest say interim government for Ukraine under di support of di UN fit replace President Zelensky, before elections hand power to a “capable government” to begin peace talks.
Di Russian president suggest say UN supervision go dey in place “in order to hold a democratic election [in Ukraine], in order to bring in a competent government wey dey trusted by di pipo”.
E say Russia go den hold peace talks with di new government, and “sign legitimate documents wey go dey recognised worldwide and be reliable and stable”.
Citing examples of di UN involvement in East Timor, New Guinea and parts of former Yugoslavia, Putin say “such practice dey exist”.
E add: “Technically, e dey possible to discuss di possibility of introducing interim governance for Ukraine under di UN auspices with di United States, with European countries, naturally, with our partners and friends.”
As a reminder, Trump tell NBC on Sunday say: “New leadership [for Ukraine] mean say you no go get a deal for a long time.”
Despite Trump change of tone with Russian President Vladimir Putin, e bin no exactly dey positive on Ukraine Volodymyr Zelensky, either.
Speaking to reporters on Air Force One, Trump bin say di Ukrainian leader go get “big problems” if e try to “back out” of di rare earth minerals deal.
On Friday, Zelensky say im government dey chook eye inside di text of di latest minerals deal e receive from the US. Zelensky say e no go accept anything wey threaten Ukraine EU integration.
Trump tell reporters on Air Force One: “We make a deal on rare earth and now e dey say, well, you know, I wan renegotiate di deal.
“E wan be a member of Nato. Well, e for no ever be a member of Nato. E understand dat. So if e dey look at renegotiating di deal, e get big problems.”
Russia continues attack on Ukraine
While Trump bin dey speak about Putin and Zelensky, di attacks on Ukraine continued.
Overnight, Russia carry out air strikes on Kharkiv – di second night of strikes in Ukraine second-largest city.
Two pipo bin dey injured in di latest attack, wey also damage private homes, Ukrainian officials tok.
In di early hours of Sunday, Russia carry out six separate strikes on Kharkiv, killing two pipo and injuring 25.
Di Russian Defence Ministry say e shoot down 66 Ukrainian drones overnight.
Dis include 41 for di Bryansk region, 24 over di Kaluga region and one over di Kursk region, e tok.
Russia don react to Trump tok?
According to Steve Rosenberg, BBC Russia editor, for Moscow no official reaction yet for Moscow to Donald Trump comments. E fit come later, but e say e no expect di Kremlin to say “we dey fear”. Traditionally, threats and ultimatums no dey go down well wit President Vladimir Putin.
But one article for one of di leading pro-Kremlin papers, Moskovsky Komsomolets, point accusatory finger back at President Trump and accuse di US president of not fulfilling im “obligations” to stop Ukraine striking Russian energy infrastructure.
Di newspaper say “all agreements on di level of President Trump only dey worth a few pennies on market day. Moscow dey prepared to make a deal with di US president, as ‘di leader of di free world’, and di undisputed boss of Nato and ‘ lordid and master of Kyiv’. But right now, di leader no dey lead, di boss no dey boss and di lord no dey direct im vassal.”
What about Ukraine reaction?
President Volodymyr Zelensky give im usual address to di Ukrainian pipo on Sunday night, and e be like say e respon to dDonald Trump’ comments about Vladimir Putin.
E say Putin “no care about diplomacy”, and e call for further pressure on Russia to end di war.
“For several weeks now, US don propose unconditional ceasefire. And almost every day, in response to dis proposal, Russian drones, bombs, artillery shelling and ballistic strikes na im we dey see,” di Ukrainian president tok.
“Russia deserves increased pressure – all di tough measures wey go break i capacity to wage war and sustain di system wey want nothing but war,” Zelensky add.
