Court for Abuja don give judgement on di death of Gospel Singer Osinachi Nwachukwu.
Justice Njideka Nwosu-Iheme of di High Court of di Federal Capital Territory, Wuse Zone 2, Abuja, sentence her husband Peter Nwachukwu, to death by hanging.
Justice Nwosu-Iheme for im judgement say Peter Nwachukwu dey guilty of culpable homicide wey result to di death of Osinachi Nwachukwu on 8 April, 2022.
Di judge wey sama Peter Nwachukwu wit death sentence tok say di sentence dey come afta court bin hold prosecution and dem get plenti proof by di law and di court find di defendant guilty.
Wen Osinachi Nwachukwu bin die, both families raise alarm, di mama for one interview wit BBC Pidgin tok say ‘Peter Nwachukwu bin tell my pikin say if she no go home alive, she go go in death’
How di court mata start
Afta di sudden death of di popular gospel artist Osinachi Nwachukwu bin go viral on 8 April, 2022, dem drag Mr Nwachukwu go court.
Na Nigeria Goment thru di Office of di Attorney General of di Federation drag am go court.
Nigeria goment sama am 23-count charge wey border on culpable homicide wey dey punishable by death, criminal intimidation, cruelty to children, criminal intimidation of children, beating of im wife, and plenti oda tins.
Mr bin show face for court on 3 June 3, 2022 to stand trial and defend imsef.
Di prosecution bin call 17 witnesses, wey include di two children of di late Osinachi.
Tori be say dem be di fourth and fifth prosecution witnesses, and goment bring 25 documents as exhibits wey dem show di court.
Di defendant Nwachukwu bin testify for im defence, im bin also call four oda witnesses and submit four exhibits to defend imsef.
Death by hanging plus 5 and half years imprisonment
According to tori pipo Channnels, befor di judge read di judgement to sentence di defendant, lawyer for Mr Nwachukwu, Reginald Nwali, bin beg di court make e no dey too hard wit di judgment.
Di prosecuting counsel, wey dey tok for goment on behalf of di late Osinachi Nwachukwu, Mrs Aderonke Imala, tell di court to give force to di law as e suppose be.
Justice Nwosu-Iheme come sentence Nwachukwu to death by hanging on Count 1, while court sama am to two years imprisonment each on Counts 2, 3, 8,9, 12, 13, and 18.
Di court bin sentence Nwachukwu to six months imprisonment on Count 10, three years imprisonment on Count 11.
Court also sama am a fine of N500,000 and N200,000 for Counts 6 and 7.
Wetin Dr Paul Enenche bin tok
Meanwhile, founder of Dunamis International Gospel Centre, di church wey di late singer bin dey attend bifor she death, Dr Paul Enenche bin don tok about wetin im know say dey worry Osinachi before she die.
Enenche for one broadcast say im bin no know say Osinachi dey suffer domestic violence.
E say im bin dey aware say di singer dey sick for some time before she well.
“Na Cameroon I dey for one crusade wey I hear of di unfortunate incident. If na domestic violence wey happun during wen she dey sick or wey make am dey sick, I know dey aware,” di pastor tok
E say all di tins wey im hear after Osinachi die dey “strange” to am.
“First I ask di twin sister if she bin know wetin say Osinachi dey pass thru all dis tins and she say she dey aware and I ask her why she no tell us.
“Di sister say Osinachi dey always beg her make she no ell me.
“Even di son tell me say dia father dey always monitor dem.
“Di last one wey touch me pass na di music producer wey tell me how di husband slap di woman inside im studio. Di producer say Osinachi beg am to leave her husband alone.
“All dis tins na wetin we just dey discover. As a pesin and as a church everybody know say we get zero degree tolerance to domestic violence.”
Who be Peter Nwachukwu?
Tori be Peter Nwachukwu bifor all dis kasala happun, na pastor for Dunamis International Gospel church, Abuja.
Na for di same church wia im wife also be one of di lead singers bifor she die.
Dem born Peter for Omaboma, for Nnewi South, inside Anambra state, South East of Nigeria..
Pesin wey dey close to am, Doctor Felix Onyimadu tell BBC say na Okekenwa dem name Peter Nwachukwu wen dem born am.
Dr Onyimadu add am say im no too sabi many tins about Peter becos im name no dey for dia register.
But report tok say Peter dey above 50 years for age.
Na for one choir ministration im meet Osinachi bifor dem two marry.
Nigeria police arrest Peter Nwachukwu, afta di death of di popular gospel artiste wey be im wife, Osinachi.
Na di FCT Police tok tok pesin DSP Josephine Adeh confam di arrest to BBC Pidgin.
She add say dem bin dey run investigation for di mata go court and now court don give judgement.
Wetin to sabi about Osinachi Nwachukwu
Di singer bin dey in her forties wen nshe die for Abuja.
Bifor her death, Osinachi na singer, songwriter wey becom veri popular for her song Ekwueme wey be collabo she do wit singer Prospa Ochimana.
Di hit gospel song bin get ova 71 million views for Youtube.
Osinachi don feature for songs like Nara Ekele by Pastor Paul Enenche and Ema You no dey use me play and also release new song wey she title God of all power.
She dey usually sing for di Igbo language wey pipo from Nigeria southeast dey speak.
Osinachi leave behind her husband and her four children.
Some pipo bin describe her voice as angelic and say e touch dem wella.
