Senator wey dey represent Kogi Central District for di National Assembly, Natasha Akpoti-Uduaghan
Di suspended senator wey dey represent Kogi Central District for di National Assembly, Natasha Akpoti-Uduaghan don land Kogi state for one home coming ceremony.
Dis dey come despite say Kogi state police ask di organisers of di event to cancel am, citing security concerns.
Dis na plus di ban on political gathering and curfew wey authorities put in place for di state, just few hours bifor di senator home coming ceremony.
Plenty of senator Natasha supporters troop out to welcome her.
Videos wey her media team share on Facebook show as dem gada dey sing and dance, and joy full dia faces.
Dem also carry placards wey dem write inscriptions like, “Welcome worthy daughter of Ebira land, di pipo of Okene are solidly behind you, “Welcome Natasha, di pipo of Adavi are solidly behind you, among odas to welcome dia senator and express support for her.
Di Kogi central senator as she dey address di crowd tok say she dey happy to come house and nobody fit stop her from coming home, as she be di true daughter of di soil.
“Nobody and nothing fit stop me from coming home, I be Ebira girl dis na my land, I no be bastard, I no dey fear anybody, I be di daughter of late Dr Jimoh Akpoti.
Natasha Akpoti-Uduaghan dey di middle of one recall process afta some members of her constituents petition di Independent National Electoral Commission (Inec) to recall her bicos dem don lose confidence for her representation for di National Assembly.
Natasha address di controversies she dey face for di homecoming
Senator Natasha land her home kontri in di company of her husband, High Chief Emmanuel Uduaghan.
As she address her supporters wey come out to welcome her, she clear di air on di issue of her suspension, di recall, plus oda controversies she dey face.
Recall process
Madam Natasha say wetin she see na how di Independent National Electoral Commission Inec dey aid and guide di petitioners on how to perfect dia illegal acts.
“Di first time wey dem submit di petition, dem no put address, phone no or any contact details. Inec go all di way out, and guide di petitioners on how to submit di informate wey go perfect dia submission”.
She raise concern say even di address wey dey di letter head carry no dey registered and wonder why Inec neva act afta public outcry on di mata.
Senator Akpoti-Uduaghan however urge di pipo of Kogi central to do right wen
Di petitioners wey come from di APC submit petition wey di letter head carry address wey no exist.
“We run check on di status of di registration of di association wey sponsor my recall, di Kogi central political frontiers and di CAC report come out negative. I still dey wait and I wonder why Inec neva make any statement to dat effect or send pipo to confam if di address dey real. Or we don reach point wey anybody or fictitious organization fit call for di recall of a senator.
“I no know wen dem go come verify you, but if di time come for di verification of my recall, I trust you would go right,” she tell her constituents.
Sexual harassment
She reiterate di sexual harassment saga and say she speak up afta deep reflection, even though she know say she go face backlash.
She add say wetin she go through na wetin many women dey go through for school, corporate organisations, wia dia bosses go dey demand for dia bodies in exchange for promotion or grades and dem no dey tok about am.
“I don speak di silent pains of many women and I dey proud to tok am, bicos next time e go dey easier for anoda woman to do so and hopefully one day law go dey wey go protect women and dem go dey safe weda dem dey married or not.”
Suspension from di senate
Madam Natasha say her suspension dey illegal, as she claim say di signatures wey dem use na just attendance sheet.
Di suspension dey saddled wit plenty irregularities and di entire procedure amount to gross injustice.
Wetin we know about Natasha homecoming ceremony