8.5 C
London
Tuesday, April 1, 2025

King experience temporary side effects of cancer treatment

King Charles III spend small time for hospital on Thursday King Charles III spend small time for hospital on Thursday

King Charles III spend small time for hospital on Thursday afta e experience temporary side effects during cancer treatment, Buckingham Palace tok.

Di King return to Clarence House wia e dey kontinu to work on state papers and make calls from im study.

E don cancel a tour of Birmingham on Friday sake of a medical advice.

Charles wey be 76 years bin don plan to travel to di city for a busy schedule of engagements wey include four events.

Di palace first announce di King cancer diagnosis for February 2024.

A Buckingham Palace tok tok pesin say meetings wit three ambassadors on Thursday also dey affected.

“Tomorrow, e suppose undertake four public engagements for Birmingham and e dey greatly disappointed to dey miss dem on dis occasion,” di palace statement tok.

“E dey hope veri much say dem fit reschedule in due course and offer im deepest apologies to all dose wey don work so hard to make di planned visit possible.”

A palace source describe am as “most minor bump for road wey dey head in di right direction”.

Di palace no provide further information ova wetin di side effects be.

Queen Camilla bin attend a reception for Wembley, north London on Thursday and no join di King during im brief stay for hospital.

Afta di palace release di news, a spokeswoman for Prime Minister Sir Keir Starmer say e dey “wish His Majesty di King all di veri best”.

Di underlying message from di palace na one of reassurance – wit di postponement of di visit to Birmingham presented as a brief setback against an optimistic picture on di King health.

No drama happun, dem go to di London Clinic hospital for central London in a car and not an ambulance, and di late night announcement follow a decision say e dey wiser to postpone Friday visit.

E fit no dey wiser to get ahead of di news and remain transparent about a minor problem, rather dan make it a major event wit a last-minute cancellation.

Di cancer treatment dey go on but be like di King no wan dey defined by im illness. E dey thrive on meeting crowds and dey show no signs of slowing down, wit a full set of engagements.

For recent weeks, e don dey on a trip to Northern Ireland, e launch a playlist of favourite music and attend di Commonwealth Day service, but e miss am last year afta im cancer diagnosis.

Di King don dey centre-stage for recent weeks, unexpectedly involve for global diplomacy.

Afta inviting President Donald Trump for a second state visit to di UK, di King den show solidarity wit Ukraine President Volodymyr Zelensky afta im disastrous meeting wit Trump for di White House.

E also give a warm welcome to Mark Carney, Canada new prime minister wey im kontri dey under pressure from Trump.

None of dat suggest say di monarch dey run out of energy. And di postponement of di state visit to di Vatican, wey dem announce earlier dis week, na about di health of Pope Francis rather dan di King – wit di rest of di visit to Italy expected to go ahead.

While recognising say e dey impossible to rule out any further health problems, di message from Buckingham Palace na say di King dey expected to be back to normal in terms of im diary next week.

Di King wider state visit to Italy dey also set to kontinu for April wit some adjustments to di planned programme, di palace tok dis week.

Di palace neva disclose di kain type of cancer wey di King get. E return to public duties last April afta a period of treatment and recuperation.



King Charles speak to guests during a reception at Buckingham Palace on Wednesday

Latest news
Related news