Fenerbahce appoint Jose Mourinho for di summer of 2024
Galatasaray say dem go “begin criminal proceedings” against dia opponent Fenerbahçe manager Jose Mourinho afta dem tok say im make “racist statements” afta di Turkish super Lig 0–0 derby on Monday.
E neva clear wey statement Galatasaray don dey tok about.
But afta di drawn game, Mourinho tok say di home team (Galatasaray) for dia bench dey “jump around like monkeys” as e also blast Turkish referees – e im tok say e go be “disaster” to use referee from di kontri.
Slovenian Slavko Vincic wey officiate di game afta both teams bin request foreign referee for dis match.
Galatasaray write for X say Mourinho “tok bad tins about Turkey pipo” since im become coach for di league.
“Dis tin don move from immoral comments to tins wey no good say pesin go tok about fellow human beings,” di club tok.
“Na so we don decide say we go begin criminal proceedings about di racist comments by Jose Mourinho, wia we go submit official complaint to UEFA and FIFA.”
Mourinho wey be former coach of Chelsea, Manchester United and Tottenham togeda wit di club Fenerbahce, no respond to di accusations yet.
Journalists ask Mourinho afta di game about 19-year-old defender Yusuf Akcicek wey play di match: “I gatz thank di referee. Afta di dive for di first minute, dia bench begin to dey jump like monkeys on top of di kid…if na Turkish referee, im go give am yellow card afta one minute wia I gat to change am afta five minutes.”
Afta di derby draw, di Portuguese tok say “I bin go di dressing room – of course di fourth referee na Turkish, wey I tok di main referee (Vincic) say – ‘thank you say you come for dis ogbonge match wey you dey responsible for dis match. I also bin turn to di fourth official wey I tok say ‘if na you be ref for dis match, e go be disaster.”
Galatasaray tok for dia statement say “we go watch wetin Fenerbahçe – wey be institution wia tok say dem dey uphold moral values’ – go tok about dis tin wey dia coach Mourinho don do.”
Di club striker Victor Osimhen also react quietly to Mourinho comment wit a post ontop im Instagram story wit “#Saynotoracism”.
Mourinho don win Champions League two times – bifor im become Fenerbahçe coach last summer.
Bifor, dem bin fine Mourinho wey im also chop suspension for comments im make about Turkish match officials since im join di club.
Bifor di Monday game, Jose bin welcome di decision to use foreign official afta im describe di environment for di kontri as “toxic”.
“I tink e dey important for di credibility, for di image of di match,” Mourinho tok.
BBC Sport don contact Fenerbahce for comment
Wetin Fenerbache tok
Inside dat statement for dia social media page, Fenerbahce tok say “pipo take di comments of our manager Jose Mourinho out of context, wia dem try to scata di tori.”
Dem add say evribodi dey see and understand wetin di coach tok.
“Di tin di coach tok na to show how di Galatasaray team and dia technical bench overreact for di incident – e get nothing to do wit racism in any way.”
“To try to make dis tin look like na racist comment be completely overreacting to di mata,” Fenerbahce add.
Di club end dia statement say “we bin inform di public say we go exercise our legal rights about dis mata – wey be incompetent slander, to change di narrative and di agenda.”
Victor Osimhen/Instagram