4.9 C
London
Monday, January 20, 2025

50,000 international students from Nigeria, Ghana and oda kontris wey apply for study permit for Canada no show for school

Report don show say about 50,000 international students wey apply for study permit for Canada to get higher education no show for di school wey dem apply to.

Di colleges and universities wey dem suppose enrol into report say di applicants no show up.

According to di goment data from spring 2024, di number of dose wey dey affected reach 50,000 from kontris like Nigeria, Rwanda, Ghana, Iran among odas.

However, na India and China be di kontris wey dey top di list of di kontris wey get di highest number of non-compliant student applicants wey no show up for di schools wey dey suppose enrol into.

Meanwhile, bifor now, Canadian goment bin announce new restrictions on work and study permit for international students wey wan undergo postgraduates studies as dem plan to reduce di number of dia annual students intake.

But dis ‘no show’ report don also raise plenti questions on if international students dey comply wit Canada study system.

In addition, anoda set of 23,514 students wey constitute 3.3% dey unreported and dis dey worry di Canada system.

Immigration, Refugees, and Citizenship Canada (IRCC) track 6.9% of all international students wey no show up afta dem apply for study permit.

Dis system of report bin dey introduced for 2014 through di International Student Compliance Regime for Canada wey require make education institutions dey report two times in a year.

Canada introduce di regime to know if international students dey actively enrolled and if dem dey attend classes for di school wey dem apply to.

Canadian universities and colleges bin submit di compliance reports to IRCC, wia dem find say tens of thousands of international students fail to obey di terms of di study permits for 2024,

Top kontris wey get highest number of international students wey no show for school

Dis na di top 10 kontris wey get non-compliant international students for Canada:

India dey top di list wit 19,582 international students wey no comply wit di study permit.

China na second on di list wit 4,279 international students wey no comply wit di study permit.

Nigeria dey di third position wit 3,902 international students wey no comply wit di study permit while 30,920 bin comply well.

Ghana dey fourth for di list wit 2,712 international students wey no comply wit di study permit, making it 31.1% non-compliance rate while only 5,881 dey comply.

Oda kontris include:

Iran wit 1,848 non-compliant international students, DR Congo wit 1,166 non-compliant international students and Bangladesh wit 984 non-compliant international students.

Vietnam dey seventh position wit 912 non-compliant international students, while Rwanda get 802 non-compliant international students and Philippines get 688 non-compliant international students for Canada.

Some sabi pipo tok say di reasons why some international students wey apply for study permit for Canada no show up na sake of illegal border crossing.

Some report say some students dey use study permit cross into Canada so dem go fit enta anoda kontri illegally while some dey also find permanent residency for Canada and dem go ignore dia school.

Wetin be di consequence

To stop how international students dey misuse study permits, Immigration Minister for Canada, Marc Miller, bin introduce strict rules wia dem announce say colleges and universities wey refuse to give dia report go dey suspended.

For any applicant to get study permit for Canada, di holder gatz dey enrolled for a learning institution and you gatz show say you dey actively pursue your studies.

Anyone wey no meet di study permit conditions, dem fit ask am to leave Canada.

Latest news
Related news