Ghana no go participate for di 2025 Afcon tournament for Morocco.
Dis na afta di blackstars fail to win dia match against Angola afta Niger don thrash Sudan 4-0 to give dem a chance.
Dis na di first time in 20 years wia Ghana no go play for di Afcon.
Despite Jordan Ayew im wonderful freekick goal for di first half, Angola control possession wia dem create more chances.
Already, di palancas negras bin qualify for di Afcon wit 12 points, wit dis one point from di 1-1 draw wit Ghana, Angola now get 13 points wit one game to spare.
Dey go play dia last game wit Sudan next week. Niger get 4 points from four games, wia dey also fit to qualify if dey win dia last game and Sudan lose dia own.
For Ghana, dis na di lowest blow for di football nation afta dey don comot for di group stage of di last two Afcon tournaments. Dey neva win single match for di group
Sabi pipo bin tok say time don reach say di Ghana football association go get beta coach to manage dis players.
“You fit get good players for your team but if you no get good coach, na waste of time, ibi like vchef wey get good ingredients but neva sabi cook well,” Kelvin Owusu Ansah bin tok BBC Pidgin.
Many football fans tok say dis na di time ghana bin get good players wia don dey play for top leagues for di world – but di results for di blackstars neva dey go well.
Oda pipo don tok say make di football association begin to “restructure football for di kontri wey go improve di local leagues and di youth teams wey go feed into di senior national team.
Oga Kelvin Owusu Ansah say “unless we focus on growing talents from di youth level including di women teams, Ghana neva go fit reach di level dem don dey many years ago.”
Second half
90+6″ Referee don blow whistle for fulltime. Angola 1 – 1 Ghana.
90+5″ Freekick for Ghana at di oda end but Angola defenders don block Gideon Mensah im shot, wia referee blow whistle for foul against ghana
90+4″ CHAAANCE! Francisco wit anoda chance one-on-one wit goalkeeper Manaf, im delay wia Ghana defender come stop di chance
90+3″ Angola take di freekick but im go wide.
Yellow card for di Ghana keeper
90+2″ Freekick for di edge of di penalty box as goalkeeper Abdul Manaf don comot im goal line to foul Zini wey don dey pursue one through ball
Dey don add 6 minutes for dis game
Even bifor dat corner, Angola don dey make anoda change. Francisco don enta di game.
87″ Corner for Angola, dem go delay time bifor dey take dis one
85″ CHANCE for Ghana as substitute Ernest Nuamah don carry di ball enta di box wey im shoot but goalkeeper Neblu save am, di subsequent ball don end in foul wey Jordan Ayew don commit
Coach Otto Addo don remove Kudus wia dey replace am wit Ernest Nuamah
84″ Time don dey go for Ghana to find di goal wey go give dem hope for dis qualifiers
Zini try to chase down one long ball wey di Ghana keeper Manaf comot come give am pressure.
82″ Milson don dey beat di Ghana defenders to create chances for Angola
Osman Bukari don enta di game to replace Kingsley Schindler for Ghana as dey try to find anoda goal
80″ Anoda Ghana attack don break down as Ayew try to play di ball inside di legs of di Angola defender.
78″ Kingsley Schindler don get yellow card afta im foul Felicio Milson
77″ Angola don dey try to control di game at dis stage wit passes as Ghana try to attack
76′ CHAAANCE! Kudus don play im shot from inside di box ova di bar, im teammates don vex say im fit pass dat ball
75″ Ghana bin try to create sometin wit Jordan Ayew but im manage to hold on to di ball wia im pass to im colleague but Gaspar don clear di ball
72″ Angola bin make oda changes. Captain Fredy don comot togeda wit Zito wia Nteka and Maestro don enta
71″ Mohammed Kudus get one chance wey im go close to di Angola box wey im shoot from range; di ball don go wide of di keeper im post
70″ Jordan drive at di Angola defense – im fall down but di Leicester City striker get up and try to continue to play but di Angola defense claim di ball from am wey dem attack Ghana at di oda end
69″ Freekick to Angola, Freddy don take am quick bifor im shoot di ball ova di bar. Alfredo Kulembe Ribeiro don hurt im thigh as im try hit dat ball. Di Bodrum player sit for ground
68″ CHANCE! Jordan Ayew drive di ball into di Angola area bifor im pass di ball to Ransford Yeboah, di Angola keeper don comot im line but Ransford delkat wey defenders clear di ball.
67″ Kudus try to beat plenty defenders but di Angola players attack am wia dem collect di ball. Ghana bin dey under pressure now
66″ Wit dis score Ghana no go qualify for di Afcon, unless dey fit win and give diaserf some hope
63″ GOOOOAAAAAL! Felicio Milson cross one ball into di area wia Wonder Zini head am into di net. Di substitute don equalize
62″ As Kudus fly di ball, Ransford Yeboah wey just enta try to beat di defender and di keeper but referee blow for foul against di Ghana substitute
61″ Jordan bin win freekoick for one dangerous area, dis time Kudus go take am wit im left foot
59″ Ghana also bin make anoda change wit Michael Baidoo out wey Ransford Yeboah don enta
58″ Angola now make dia changes. M’bala don comot, na so Fortuna also don comot wey Zini and Carneiro don enta
57″ Fredy try to pass one through ball for di back of di Ghana defense but Gideon Mensah don clear am
56″ Angola bin dey prepare to make two changes
54″ CHANCE! Angola try to create sometin but Razak Simpson don put im body for line to clear di shot bifor di Angola player strike di final ball ova di bar.
53″ Angola don begin dey control di game again wit good passes from right to left.
51″ Show don dey spread di ball for midfield bifor Fortuna try to cross di ball into di box, Elisha defend di ball wia Ghana eventually get throw-in.
50″ Milson and Luvumbu both enta di Ghana box wey dem try to play di one-two, but Ghana defend.
49″ Throw-in for Ghana as Elisha Owusu and Alidu combine to stop Milson for di touchline.
48″ Shot by captain Freddy from long range – im ball enta row z!
47″ Freddy from Angola don fall for ground under pressure from Ebenezer Annan. Freekick for di palancas negras but e neva trouble Ghana.
46″ Afta referee don blow whistle Ghana begin to attack wit Kudus, but di Westham man fall for ground inside di box, im dey look for penalty but referee say play on.
Players don return for di second half
Ghana bin make one change – wit Ebenezer Annan wey don replace Fatawu Issahaku
First half
Halftime; referee don blow whistle.
Luvumbo na di dangerous player for Angola dis first half.
45+3″ Fredy don take di freekick into dio Ghana box but Kingsley Schindler don clear di ball
Yellow card for Fatawu Issahaku as im foul Luvumbo.
45+2″ Ghana try to create sometin but Michael Baidoo don choose di wrong option wia im lose possession.
45+ 4 mins bifor di first half go end.
45″ Freekick to Ghana as Jordan Ayew try to run di ball pass di Angola marker but im don foul di Leicester City striker.
43″ CHANCE! Di ball fall to Kudus wey di Westham man don drive enta di Angola box bifor im cut di ball to Michael Baidoo but di Elfsborg forward don miss di ball
42″ Gaspar don carry di ball dash Ghana inside di midfield now di blackstars don dey try to pass pass di ball as halftime dey approach.
41″ Freekick for Ghana as Fortuna don foul im opponent.
40″ Angola bin dey dominate possession but Razak Simpson don dey clear all di long balls by di Angolans
39″ Issahaku don go back to help Gideon Mensah to defend one dangerous ball from Luvumbo
38″ Since di Ghana goal, all di oda chances dey fall for Angola
37″ Ghana try to stop di pressure on dem at di back wit one long clearance.
36″ CHAAANCE! M’bala wit anoda chance as im head one weak ball towards di ghana goal, na so Abdul Manaf don catch am.
Di home crowd bin dey cheer every pass from Angola now
35″ CHAAANCE! Felicio Milson don take on two Ghana players bifor im enta di box and try to score but di ball go out for corner.
33″ Leicester City forward Fatawu Issahaku still dey feel some pain, as im sit for ground.
32″ Fredy and Da Silva dey try to create sometin for Angola but e neva dey dangerous
31″ Everytime Angola don dey attack di Ghana area, e dey dangerous, dem try anoda cross into di Ghana box but di ball go over di bar
29″ Zito Luvombo dey roast di ghana defender Gideon Mensah for di back, bit dis time di oda defenders clear im cross bifor Jordan Ayew foul im player.
28″ Di blackstars don defend di ball afta di keeper save dat penalty. Di score remain Ghana 1 – 0 Angola.
27″ M’bala don miss di penalty as Ghana keeper Abdul Manaf use one hand save di ball.
25″ M’bala Nzola go play dis penalty.
24″ PENALTY to Angola! Lovombo try to enta di box, na so Gideon Mensah foul am. Chance for Angola to equalize
21″ Afta play don start, Fatawu Issahaku don try to attack di Angola area but im pick up wetin dey look like injury for im knee
20″ Razak Simpson don dey floor afta one Angola player chook am elbow.
Di captain of di team wey score di opening goal.
17″ GOOOOOOOAAAAAAALLLLL! Leicester City striker Jordan Ayew score from a direct freekick from 30 yards! Ghana lead 1-0
17″ Anoda foul in front of di Angola box, afta foul on Kudus.
16″ Yellow card for Show afta im hack down a Ghanaian player for di center circle.
14″ Both teams dey try to slow down di ball so say dey fit to pass pass but so far, e don dey scruffy.
13″ Freekick to Ghana, for Carmo im foul on Kudus.
12″ Angola thread one ball behind di Ghana defense but goalkeeper Manaf comot im line come carry di ball
Ghana bin dey under pressure for di back. Angola win dia first corner. Di ball don pass everibodi wia e fall to Show, but im header dey weak, Ghana don win freekick in dia own area.
10″ di blackstars wan put one ball ova di top for Jordan make he chase am but Issahaku im ball dey too hard.
9″ Angola now dey try enta di Ghana area but Razak Simpson wey don dey play im first game for Ghana don clear di ball
8″ Kudus don hit di freekick wey Angola clear, di subsequent throw-in no trouble di palancas negras.
7″ Anoda freekick on di edge of di Angola area – dis time na Show wia foul Mohammed Kudus. Chance for Ghana
6″ Jordan Ayew hit di freekick but di Angola defense clear di ball bifor Issahaku smash one shot wit im left foot wey go wide.
Ghana win freekick in front of di Angola area after Show fould am.
5″ Sulemena don dey ground for di center circle afta an Angola player hack am down.
4″ CHAAAAAANCE! Angola break away wit Zito – im beat Gideon Mensah wia he cross di ball into di area but Milson im header dey weak.
3″ Angola keeper Neblu don comot for im box to clear one ball wia di Ghana attacker bin dey pursue
Early possession for di blackstars wit Issahaku and Kudus as dey pass di ball in di Angola area.
2″ Angola begin dey press for di ball; di blackstars players no dey get time to pass.
1″ Felicio Milson don commit di first foul of di game under one minute.
Ghana bin dey wear dia traditional all-white jersey as Angola don wer dia red jersey
Di home crowd alreadi begin to cheer dia players on as referee don blow whistle fpr di gam,e to start.
1″ Both teams dey for di pitch as dem dey sing dia national anthems.
Angola vs Ghana line ups
Ghana XI: Abdul Manaf Nurudeen (GK), Alidu Seidu, Razak Simpson, Gideon Mensah, Kingsley Schindler, Ibrahim Sulemana, Elisha Owusu, Michael Baidoo, Abdul Fatawu Issahaku, Mohammed Kudus, Jordan Ayew ©
Angola XI: Neblu (GK), Kialonda, Bastos, Carmo, Fredy, Hossi, Show, Fortuna, Zito, Nzola, Milson