“I go fight with my last blood to get justice for my daughter”.
Dis na wetin di mother of late Priscilla Ocheme, di 28-year-old medical practitioner wey die on 22 September, 2024 for Abuja, di Nigeria capital tok.
Di family still dey mourn dia daughter and sister wey dem allege say foul play dey for her death.
She bin go visit a male friend before dem begin find her den police report her dead.
Police for statement say di late Priscilla Ocheme die from “a fatal motorcycle accident for Amala Moore junction in Pyakasa” Lugbe, Abuja.
Police add say dem bin carry her go Pyakasa Health Centre, from dia dem refer her to FMC Jabi “upon arrival for di medical centre di doctor on duty confam her dead”
However, di family no agree with wetin police tok, as dem dey allege foul play.
Her family dey beg Nigerian authorities and individuals to help dem get justice. Her
mother wey dey 56 years and widow for 24 years now siddon with BBC Pidgin wia she tori how di mata go.
Priscillia last moments with her family
Di bereaved family tell BBC Pidgin say e be like dream for dia eyes, sake of say dem bin no know say dat Sunday 22 September na di last time dem go see, hear, speak or chat with Priscillia as dem recount dia last moments with di Public Health practitioner.
“Dat faithful Sunday she cook hot rice, veri hot rice for us, I dey go church early so I leave her for house go church, I bin no get any idea say she even go see her friend.
Priscillia elder sister also share di last moments she get with her sister and di pain wey she dey feel inside. She tell BBC Pidgin say she and her late sister dey very close to di point wey be say she dey call her “my handbag”
She explain say e dey strange for she and her sister not to tok to each oda for one day and di last time she see her na on Saturday 21 September, 2024.
“I tok to her for phone on Sunday morning, afternoon and evening and na di last time be dat.”
Priscilla sister say all of dem begin worry wen dem no see her or hear from her and she no come back house wey dey very unusual.
Na her aunty wey later tok say one number bin call her to inform dem say di owner of di phone get accident around Lugbe area and dem carry her go hospital.
She narrate say all of dem begin search for hospitals wey dey near Lugbe but to no avail, until dem reach out to Road Safety wey confam say dem get report of okada accident.
Na Road Safety Officers tell dem wia dia sister dey bifor police tell dem dia own story.
“On Sunday at 8:28pm for evening, she bin send me message make I send herN10,000, I try send di money to her, dem debit me but no credit her, e dey show pending for my app but dem don already debit me. I kon tell her say make we no do di transaction two times, make we wait small weda dem go reverse am or she go get am.
I bin get catarrh so I take medication wey make me sleep off, as I wake up di next morning na wen I remember say I suppose send my sister money o.
Wen I check my mobile app I I see say di money reverse around 10 pm for night. I no bother to call her again, I just transfer di money sharp-sharp and e dey successful.
I chat her up say I don send di money, she no reply, unlike my sister, becos if she ask for money like dat from me , she go call, send message. I no see any message for morning wen I wake up, I no know say na night my sister die.” She tok.
‘We suspect foul play’
Prisillia family say dem dey suspect foul play with di way she die.
Dem allege say di timeline of events from wen dem say she comot from di house of di friend wey she go see and wetin police tell dem of how she die no rhyme at all.
Dem also allege say police no fit produce di ‘Good Samaritans’ wey bin carry her come station from wia di accident take happen nor di oda pipo wey dey involved for di accident.
“For me not to hear from my sister for a day, na big tin for me, most of di time wen you see me you go see my sister, in a day she fit call me like 10 times becos we dey always tok for phone. E dey veri difficult for me say I neva hear from her, I neva see her missed call, I neva see her message till now, na veri big tin for me and I dey miss her well-well.” Priscillia sister tok.
‘I go continue to seek justice for my daughter’
Di mother of di late Priscillia Ocheme dey heartbroken as she tok about di kain pesin her daughter be.
Mrs Ocheme cry as she reflect on di last moments she get with her daughter before dis long and everlasting silence from her pikin.
“She be number four for my children, she be my companion, my friend wey I fit confide in and I dey feel like say make I dey di same mortuary with my daughter right now.
Mrs Ocheme tell BBC Pidgin say her late daughter Priscillia bin dey four years wen dia papa die and she don dey live alone as widow for di past 24 years.
She narrate to BBC Pidgin say, Priscillia no be pesin wey dey sleep outside dia house except she dey for school, and immediately holiday reach, she dey come back house.
“She be di kind of pesin wey no dey comot from house, she dey work online and also do her business, she be Make-Up artist, she be pesin wey I no go forget for my life. Right now I dey feel like say I no dey dis world”.
“I dey cry, I dey beg di whole world to help me becos for me to take care of my children to make sure say dem dey educated (go school) den close to her breakthrough, pesin go come eliminate (kill) my pikin like dat. Infact to di last of my blood I go continue to seek justice for my daughter” she tok with tears for her eyes.
‘Investigations still dey go on’ – FCT Police tok
Meanwhile di Federal Capital Territory, FCT Police Command maintain say Priscillia die from accident.
For statement wey dem title “Case involving di alleged murder of Priscilla Ocheme: Investigations ongoing.”
Police say pipo draw dia attention to tori wey dey fly upandan for social media wey concern di alleged murder of Miss Priscilla Ocheme by her boyfriend for im house for Lugbe.
Police say dem bin invite di suspect for questioning on 24 September 2024. “Preliminary investigations revealed say di suspect, 30 years old man from Oredo-Benin for Edo State, bin meet di now-deceased Priscilla for Madonna University.
Im lose contact with her wen im comot from di university until 2019 wen im bin comeback to di FCT for im youth service.
Na well-known family friend wey dey frequently visit di deceased for her family home, just as she dey visit im own.”
For di statement wey FCT tok-tok pesin, Josephine Adeh sign she explain say na “on 22 September 2024, she (Priscilla) bin get minor misunderstanding with her mother, wey make her comot from her family home for Karu area come go di house to cool off.
She eventually comot from im house dat evening dey go her house wen she get a fatal motor cycle accident for di Amala Moore junction for Pyakasa.”
Police say two laborers, Jerry Amos and Moses Bala, wey bin dey work nearby for one “brick-producing factory rush her to Pyakasa Health Centre for medical attention, dem later refer her to Federal Medical Centre Jabi, with two police detectives.
Wen dem reach di medical center, di doctor on duty confam her dead”.
Even though di FCT Police Command say dem dey do dia work with “professionalism and integrity for investigative processes and no go eva spoil dia name with unethical (mago-mago) practices or any actions wey go compromise di trust of di public wey dem dey serves, di family of Priscillia say police no dey tok true for dis mata.
Priscilla mama say she bin no get any issue or quarrel with her daughter wey make her comot from house.
Di family say wetin make dem push for di mata to go further na sake of say police release di friend wey Priscillia bin go see before she die, wen dem claim say investigation still dey go on, and dem release am witout dia notice.
Di family add say dem don write petition to di Inspector General of Police to chook eye for di mata so dat di late Priscillia go get justice.
BBC Pidgin also try to reach di late Priscillia male friend wey she bin go see before she die for comments.
Profile of late Priscillia Ocheme
Dem born Priscilla on 2 February, 1996 for Abuja.
She attend Lavouge International Nursery and primary school, from dia she enta Sokoga British Secondary School from 2008 -2013.
She study public health for Madonna University, Nigeria wia she spend only two years.
She later graduate from Adeleke University, Ede with a Bachelor of Science Degree for Public Health for July, 2019.
She bin do di compulsory National Youth Service Corps (NYSC) for 2020.
Priscillia wey be di fourth child of her parents live with her family for Abuja all her life, until her death on 22 September, 2024.
According to her family and friends she live a good life and touch so many lives positively.
“Priscilla na selfless person wey dey always want to see di good inside oda pipo, she dey practically put oda pipo needs above her own and she dey full of compassion bifore her death.” Dem tok.