Di President and Chief Executive of Dangote Group, Aliko Dangote, on Tuesday say e sure for am say im refinery na di solution to di fuel queues across di nation.
Dangote, bin tok to State House tori pipo for Abuja, wia e urge di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) and marketers across di kontri to stop di importation of fuel.
“Wetin I estimate as our daily consumption na about 30-32 million litters, dat one we fit even start producing by next week. Dat no really be issue becos as we speak today, we get 500 million litres for our tanks.
“Wit dat, even if production no dey anywia or no import, dat go take di kontri more dan 12 days,” Dangote tok.