Di bank say dem don hand over di case to di appropriate authorities.
Access bank for Nigeria say dem don hand over di case of alleged privacy violation involving one of dia former Contact Centre agent to di appropriate authorities.
For press statement on dia verified handle on Monday di bank say dem dey corporate wit authorities on di matter, say dem dey committed to upholding di highest standard of safety and privacy of dia staff and customers.
Tori been comot for local media over di week say Access Bank staff feem about 400 nude videos of female staff inside restroom witout di knowledge of di victims.
Local tori pipo FIJ report say di suspect name na Stephen Ejezie. Di tori tok say authorities been arrest di suspect but say dem later release am and e dey walk free while di victims suffer.
FIJ allege for dia story say Access bank don sack di staff after di incident but be like dem no wan prosecute am to protect the image of di bank
Wen we contact police to find out whether dem truly arrest du suspect and why dem release am, di tok tok pesin for Lagos state Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin say im go check out di details of di case and get back to us.