8.5 C
London
Saturday, April 26, 2025

Ukraine fit need to give up land for peace

Ukrainian President Volodymyr Zelensky (L) and President Donald Trump bin clash for di White House Ukrainian President Volodymyr Zelensky (L) and President Donald Trump bin clash for di White House

Di mayor of Kyiv, Vitali Klitchko don tell BBC say Ukraine fit need to give land as part of peace deal wit Russia.

E tok dis one as pressure dey grow wit President Donald Trump to accept territorial concessions dey mount.

E tok say, “one of di scenarios na… to give up territory. E no dey fair. But for peace, temporary peace, maybe e fit be solution, temporary”.

But di 53 year old former boxing champion wey turn politician hala say Ukrainian pipo “no go ever accept occupation” by Russia.

E bin dey tok hours afta one Russian missile and drone attack for Kyiv kill 12 pipo and injure ova 80 odas.

Na one of di deadliest attacks from Russia on di Ukrainian capital in months.

Russian President Vladimir Putin bin launch full-scale invasion for Ukraine for 2022 and Moscow currently dey control around 20% of Ukraine territory.

Klitchko na now one of di most senior Ukraine politicians wey go comot publicly say im kontri fit need to give up territory, although temporarily.

Di Kyiv mayor and Zelensky na political opponents. Di mayor don repeat accuse against di president say im and im team dey try to undermine im authority.

Speaking to BBC Radio 4 Today programme from im office for central Kyiv on Thursday, Klitchko note say na im dey “responsible for di capital of Ukraine” wey im call “di heart” if di war torn kontri.

Wen dem ask am weda Zelensky dey discuss wut am any details of possible settlement, Klitschko tok no.

E add say, “President Zelensky dey run dat onn imself. No be my work.”

Klitschko bin tok about di February kasala between Trump and Zelensky for White House say e for beta if dem no tok wetin dem tok wi cameras.

Earlier dis week, Trump accuse Zelensky say e dey harm peace negotiations afta di Ukraine leader no gree recognise Russia control of Crimea wey be di southern Ukrainian peninsula wey Moscow illegally annex for 2014.

Trump say Crimea don go tay-tay and e no currently dey as “point of discussion”.

But Zelensky point to one 2018 “Crimea declaration” wey Trump den secretary of state, Mike Pompeo bin create wey tok say di US “reject Russia attempted annexation”.

Ukraine and dia European allies in recent weeks don express alarm ova wetin many pipo for di continent see as Trump padi-padi relations wit Vladimir Putin Russia.

Latest news
Related news