Reports from Kwara State wey dey North Central Nigeria show say one new militant don show face
Reports from Kwara State wey dey North Central Nigeria show say one new militant group wey dem dey call Mahmuda don show face, and dem dey claim say dem be jihadists.
Recently, dem don dey attack plenty communities wey dey under Kaiama and Baruten local govment areas for di state.
Some reports even tok say di gunmen don dey hide for Lake National Park, from wia dem dey launch attack for both Kwara and Niger states.
Pipo for Kwara tok say di group don dey di region since 2020, and as time dey go, dem begin get ground well well and turn to strong force.
Dia attacks make many pipo begin dey run comot from dia homes go nearby villages wey dem believe say e safe pass.
For one interview wit one resident from Baruten local goment area, Seko Jibril tell BBC News Pidgin say dem suspect say some of di armed men na Boko Haram members wey escape from North East Nigeria sake of constant attack from Nigerian Army.
According to am “Dis new group, we believe say dem come from North East Nigeria, and some of dem na Boko Haram members wey run comot from dat region come our state.”
Jibril still add say “Dem don dey for ground for Kwara since 2020, and na from dia dem begin attack and colonise some villages.”
E also tok say di way Mahmuda militant group dey operate resemble Boko Haram style, sake say dem dey kill and slaughter pipo anytime dem attack.
“Dia operation just like Boko Haram own dem go attack, kill, and slaughter pipo.”
Howeva, e mention say di communities wey suffer pass say na places like Karunji and Kermanji wey dey Baruten local goment, wia di attacks don turn nightmare for pipo.
“Dem don bring serious wahala for our pipo, plenty pipo from Karunji and Kermanji don run comot sake of fear. Dem don relocate go Chikanda, Ure, Kayama for safety.”
Jibril add say “Di Mahmuda militants go enter community, kill pipo, shoot dem, carry dia money, food, and any oda valuable wey dem fit find.”
E add say some weeks back, di militants retreat wen Nigerian military and local vigilante group face dem wit fire as dem try attack one community.