7.7 C
London
Sunday, April 27, 2025

More dan 150 pipo injure as earthquakes shake buildings for Turkey Istanbul

Several earthquakes including one 6.2-magnitude tremor don strike near Istanbul Several earthquakes including one 6.2-magnitude tremor don strike near Istanbul

Several earthquakes including one 6.2-magnitude tremor don strike near Istanbul, e shake buildings for Turkey largest city and e force some pipo to run from dia apartment blocks.

For now, no immediate reports of casualties or wider damage, but Istanbul officials say dem dey check buildings, den warn pipo to stay clear of potentially-damaged sites.

Di largest earthquake on Wednesday bin strike around 12:49 local time (09:49 GMT) at a depth of 6.92 km (4.3 miles), na wetin Turkey emergency services tok.

Di epicentre of di 6.2-magnitude tremor dey located along di coast of di Sea of Marmara, for Silivri area about 80 km (50 miles) west of Istanbul.

Turkish officials bin report two oda smaller earthquakes, also dem record aftershocks.

Istanbul residents report bigger earthquake, dem say na one of di strongest dem don feel in years.

Pipo bin report say lamps and oda furniture fall down for floor for dia homes.

Selva Demiralp, wey be economics professor for Koç University, tell BBC say she bin dey wit her family for one high-rise building wen di earthquake strike according to am, e bin dey “quite scary”.

“Somehow, in di midst of di earthquake, we bin feel a deep sense of comfort—becos di whole family bin dey togeda,” she tok.

“We dey safe, e look like say e no damage buildings,” she tok. But she add say pipo bin dey nervous about whether di quake “na a foreshock itself” and di “real one still dey come “.

For 2023, two giant earthquakes bin destroy southern Turkey, e kill more dan 55,000 pipo.

Istanbul na Turkey most populous city and na home to 16 million pippo – a fifth of di kontri residents. Di city dey just 20km to di north of di North Anatolian Fault Line.

Latest news
Related news