Innocent Idibia, wey pipo sabi as
Benue state govnor Hyacinth Alia don appoint Innocent Idibia, wey pipo sabi as “Tuface” as adviser on Technical Adviser for Entertainment and Community Outreach for Benue State.
For one video wey don dey make di rounds for social media, di govnor announce di appointment during di artiste visit to di government house.
During im speech, govnor Alia tok say e wan give Tuface more responsibility as entertainment guru to help improve oda pipo life and help di goment gain more “wisdom and advisement” in di entertainment industry.
E tok say Tuace deserve di appointment becos of im support for im administration.
“So we dey happy you dey here. On behalf of di state goment and our very good pipo, you be guru of entertainment. We wan give you more responsibility to help from im improve oda pipo life and to gain more from your wisdom and advisement as well. I dey please to announce say we go make you Technical Adviser to di govnor on Entertainment and Community Outreach,” di govnor announce.
Dis appointment dey come even as Tuface dey in di news sake of im divorce from im ex-wife, Annie Macauley after 10 years of marriage.
Di couple get two pikin between dem, dia first daughter Isabella, dem born am for 2008 and Olivia dia second daughter for 2014.
Dem born Nigeria music star Innocent Idibia aka 2Face for Jos, Plateau state, north-central Nigeria. E hail from Benue state.
2Face na ogbonge Nigerian singer, song-writers and record producer. E dey regarded as one of di most influential and greatest Afrobeat artists of all time sake of im contribution to di Nigerian music industry for di past two decades.
Im professional music career wit Plantashun Boiz (one group wey no dey again). Dem be three wey form di group, himself and two odas – Blackface and Faze.
Plantashun Boiz release two successful albums: Body and Soul (2000) and Sold Out (2003) under Nelson Brown label, Dove Records, bifor dem break-up for 2004.
Afta di disbandment of Plantashun Boyz for 2004, all band members bin go solo for dia musical careers. 2Face release im debut solo album Face 2 Face for 2004 wey make am tanda gidigba as solo artist.
E don release several albums afta dis one and win plenty awards wey include; MTV Europe Music Award and World Music Award, The Headies Award for Song of di Year, Channel O Music Video Awards, and BET Award.