16.7 C
London
Saturday, April 26, 2025

Who be Cardinal Kevin Farrell, di acting head of di Vatican?

Farrell don work for ova 30 years for US, dem born am for Dublin Farrell don work for ova 30 years for US, dem born am for Dublin

Wen di world hear of Pope Francis death on Monday morning, na Irish-American cardinal, wey di world no know na im break di news.

Afta im announce say di pope don “return to di home of di Father”, Irish-American Cardinal Kevin Farrell take on one of his biggest roles yet: di “camerlengo”, or di pesin wey dey run di Vatican afta di death or resignation of a pope.

Na Pope Francis bin nominate di cardinal for di role for 2019. Di cardinal go remain for di position during di “Apostolica Sedes Vacans”, dat na di period between di death or resignation of a pope until di election of di next pontiff.

Im go also play an important role for di centuries-old ceremonies to mourn Pope Francis.

Dem born Farrell for 1947 for Dublin, Farrell attend di University of Salamanca for Spain and di Pontifical Gregorian University for Rome, according to di Vatican.

Im don hold different appointment for churches around di world, e serve as a chaplain for di University of Monterrey for Mexico as well as parish for Bethesda, Maryland.

All togeda, di 77-year-old don spend more dan 30 years working for churches for US.

Farrell bin collect appointment as Bishop of Dallas for 2007 e bin dey dia until Pope Francis ask am for 2016 to serve as di leader of di Vatican new department wey dey responsible for di pastoral care of families, wey raise am to di rank of cardinal.

Years afta dem name am as camerlengo, For 2023, Francis chose Farrell as president of di Supreme Court of Vatican City State. Dem also name as di president of di Commission for Confidential Matters.

As camerlengo, part of im Cardinal Farrell work na to make arrangements for di conclave, di process wey dem go select di next pontiff.

Technically, a camerlengo fit become pope, e don happun twice in history: Gioacchino Pecci (Pope Leo XIII) for 1878 and Eugenio Pacelli (Pope Pius XII) in 1939.

Di cardinal also go preside ova di certification of Francis death, To put im body inside di coffin.

Afta dat, di cardinal dey expected to lead one procession wey go move di pope body from di chapel of di Domus Santa Marta to St Peter Basilica.

Di ceremony fit take place as soon as Wednesday morning, according to di Vatican.

Latest news
Related news