Di late Shimite Winifred Bello
Delta State Police Command tok say Pastor Favour, husband to di late Shimite Winifred Bello wey die, don dey under dia “protective custody” ova concerns of im safety from di family of im late wife afta dem lodge complain to police say na di deceased husband kill am.
SP Bright Edafe, wey be di state police tok-tok pesin, tell BBC News Pidgin tok say di allegations against di husband say im kill im wife wen dem bin dey fight “na just social media propaganda and notin like dat”.
Di tok-tok pesin say di deceased husband call police on Monday morning to report say “im wife fall sick and die” dis morning but her family dey threaten to attack am.
Edafe tok say dem go conduct autopsy on di body wey dey for mortuary to determine weda she die of natural death or any oda tin dey attached to her death, but for now dem dey treat di death as “natural death”.
“We no get any report of any confrontation wit di husband, na di husband call dis morning, and e tok say im wife fall sick and die dis morning. However, im dey get threat say di family of di woman fit attack am.
“Im call di police, we take am in on protective custody. Di bodi don dey deposited for mortuary and e dey await autopsy,” Edafe tok.
E say since di family of di woman don lodge complaint against her husband, dem go do autopsy to confam di cause of death.
“However, di allegation say dem dey fight na just social media propaganda, notin like dat.”
Di police clarification dey come afta social media reports dey allege say di deceased die of domestic violence afta she confront her husband, Pastor Favour.
Tameta Sunday, wey be aide to Shimite Winifred allege say na her boss husband, Pastor Favour kill her. E describe am as “ugly soul wit gentle looks”.
“E dey very difficult to type RIP Boss Shimite White Eagle knowing fully well ugly soul wey dem dey call pastor wit gentle looks as husband cut all di positive plans wey we get togeda in oda to make evri of your followers smile wit inline of More Agenda of Rt Hon Sheriff Oborevwori just on Thursday here last week and today you no dey anymore, wia we go start from now, make I start to blame or dis na still April fool to us,” e tok.
Harrison Gwamnishu, wey be di Senior Special Assistant on Civil Society and Youth Mobilisation to di Delta State govnor, react to di death of im colleague for one Facebook post: “Life. Tired of hearing bad news. RIP beautiful Shimite White Eagle”.
Who be Shimite Winifred
Shimitte bin serve as di coordinator of di Delta State UNIDO Centre.
She dey among di vocal pesins for di implementation of di Federal Government Social Investment Programme for Delta State.
Shimite bin produce and present “African Pot”, TV documentary, wey bin promote traditional African cuisine, tourism and culture.
She bin dey di committee of USAID/NEXTT (Nigerian Expanded Trade and Transport) – Lakaji Trade Corridor.
Also, she be di member of di Board of Directors of FESECA – Foundation for Economic Change in Africa.
She bin serve as Contributing Editor on Travel and Tourism wit Daily Trust, Leadership and odas.