16.3 C
London
Saturday, April 26, 2025

CCTV reveal how gunmen brutally kill 77-year-old Nigerian Uber driver for US

Jaguda pipo shoot and kill one 77-year-old Uber driver Jaguda pipo shoot and kill one 77-year-old Uber driver

Jaguda pipo shoot and kill one 77-year-old Uber driver wen im bin pick up one passenger outside of Center City hookah lounge on 16 April.

Police for Philadelphia, United States don confam one surveillance video wey don go viral.

Di video capture di moments wen di jaguda pipo shoot and kill di Uber driver and im passenger on Wednesday morning.

CBS news report say di shooting bin happun wen di Nigerian Uber driver, Olatunji W. Bolaji of Norristown bin sidon for im black-colour Chevy Suburban.

Im bin park di car for 18th Street around 2 a.m. on April 16, police tok.

Di jaguda pipo bin shoot Bolaji for head and dem bin manage to drive im car to di corner of 18th Street.

According to police, dem turn right enta Chestnut Street wia im car bin jump di blockade con hit one light pole.

Paramedics confam say im die for di place wey di incident happun.

Wetin happun to di passenger

Dem bin also hit di passenger wey be 22 years old, wey im bin go pick up for arm, leg and abdomen, police tok.

Dem bin rush am go hospital sake of say im condition bin dey veri critical.

Oda pipo dey for communities too communities wey dey endure gun violence for Philadelphia.

Surveillance video from one nearby building, show say as Olatunji Bolaji bin park im Chevy on 18th Street around 2 a.m.

Four pipo bin waka comeout from di lounge, dem begin waka go towards im car.

One man, wey be di 22-year-old passenger, bin open di door to enta wen two oda men run go meet am and start to fire dia weapons for im body.

Investigators tok say, no argument or any kind of kasala bin dey between di shooters and di passenger bifor all dis bin happun.

Dem believe say di shooters bin dey drive one dark Jeep Grand Cherokee wit Massachusetts tags.

Loved ones mourn death of Uber driver

Neighbors tell NBC10 say dem dey sad to hear about di murder of Olatunji Bolaji and describe im family as quiet and hardworking pipo.

One of dia long-time family friend wey bin live wit Bolaji for many years say, di late Bolaji na nice man wey dey always want to help pipo.

Im say Bolaji bin dey work veri hard and na loving partner and father wey im son na college graduate.

Di friend explain say Bolaji family dey heartbroken and dem want justice for di man wey jaguda pipo just kill like dat.

“Our hearts break for di driver family and loved ones sake of dis devastating loss,” one Uber tokp-tok pesin bin write for statement.

“We don reach out to police to offer our support as dem dey work to bring di pipo wey dey responsible for dis heinous act of violence to justice.”

Dem don also open a GoFundMe to support Bolaji family, dem go use di money wey dem go raise do di burial and memorial service expenses.

Dem go also give di immediate family for dia living expenses during dis period of grief and counseling services for family members.

Di Philadelphia Police Homicide Unit dey actively investigate di incident, police tok. Dem neva arrest anybody yet.

Dem dey beg anybody wey get information to contact di police. Like for all Philadelphia homicide cases, dem don put $20,000 reward for information wey fit lead to di arrest of dis jaguda pipo and dia conviction.

Latest news
Related news