20.6 C
London
Sunday, April 27, 2025

Burkina Faso army say dem scatter ‘major’ coup plot to overthrow Ibrahim Traoré

Security Minister Mahamadou Sana bin announce di foiling of di coup on television on Monday Security Minister Mahamadou Sana bin announce di foiling of di coup on television on Monday

Burkina Faso military goment say dem don scatter ogbonge plot to overthrow dia military head of state Capt Ibrahim Traoré.

Di army allege say di coup plotters base for neighbouring Ivory Coast.

Security Minister Mahamadou Sana say na current and former sojas wey dey work wit “terrorist leaders” na dem lead di coup attempt. Di intention na to attack di presidential palace last week, e tok.

Di aim of dia plan na to “sow total chaos, and place di country under di supervision of an international organisation”, Sana tok for state television on Monday.

Dis na di latest of several claims of attempts to remove di junta leader who bin seize power in 2022 following increasing militant attacks.

Burkina Faso, like dia Sahel neighbours, bin don dey battle armed jihadist groups, as an estimated 40% of di country currently dey under di control of dis groups.

Despite promises by Capt Traoré and im military government to improve security and even as dem dey seek new security partnerships wit Russia, di situation still dey critical wit frequent attacks from insurgents.

For dis latest coup attempt wey happun last week but details just dey come out, Sana say di plotters bin wan use religious and traditional leaders to sway army officers into backing dia plan.

“According to di terrorist plotters’ plan, di ogbonge manoeuvre suppose happun on Wednesday 16 April, 2025, wit an assault on di presidency of Burkina Faso by a group of soldiers recruited by di enemies of di nation,” e tok.

“Di brains outside di kontri dey located for Ivory Coast,” e add, as e mention di name of two former army officers wey dem dey accuse to be behind di plot.

Sana tok say “sensitive information bin dey passed on to “terrorists” to increase dia attacks on di military and civilians and “incite a revolt against di authorities”.

Last week, several military personnel, including two officers, bin dey arrested for planning to “destabilise” di goment, security sources tell tori pipo, AFP news agency.

Di Ivorian authorities neva comment on di claims say dem dey hosted di coup plotters but di Burkinabe junta don often blame dia southern neighbour of supporting its opponents in exile.

Dis latest claim dey come months afta Ouagadougou say dem stop anoda “destabilisation” plot against di junta last November.

Burkina Faso, along with two oda military-led states – Mali and Niger, don break away from di regional West African bloc, Ecowas, to form a new alliance.

Dem don also cut ties wit dia former colonial power France and dem don join bodi wit Russia instead

Latest news
Related news