Priscilla Ojo and her bobo Juma Jux
Actress and content creator, Priscilla Ojo dey run part two of di many weddings wey she dey do wit her Tanzanian bobo, Juma Jux.
Priscilla wey be di pikin of popular actress, Iyabo Ojo don so far run do first half wetin local tori pipo dey call four weddings for wia her bobo come from, Tanzania for February.
Dem do Nikkah and also civil joining for di kontri. Dis na wia she for get her Muslim name Hadiza Mkambala.
Tori be say dem enta Nigeria to run di Yoruba rights.
Di whole mata around di wedding start to trend around August of last year wen di two both of dem snap with aso-ebi for wetin bin look like pre-wedding shoot.
E cause serious debate around di kontri giving say her collabo series, wit social media star Enioluwa, All of Us bin just launch just di month bifor.
According to Priscilla, she bin meet Juma Jux wey im real name na Juma Mussa Mkambala for business trip wey she go do for Rwanda.
Di two of dem bin jam for di hotel wey she bin dey lodge at which time di 35-year-old musician give di 24-year-old im number to text but she say she no gree but las-las dem land for inside di marriage sha.
Howeva di Ololufemi singer tok say wen e see her, e bin know say na she go be im wife.
Who be Priscilla
Priscilla Ajoke Ojo Mkambala na content creator, actress and business woman wey dem born for di 13 March, 2001.
She get her Bachelors Degree for Mass Communication for June 2021 but even bifor all dat time she don cement herself for di content creation space for Nigeria social media as teenager.
From her fashionista influence wey she dey slay wit her clothes come go di content wey she create wit di likes of Broda Shaggi.
Priscilla reach di height of her social media fame afta she collabo wit bestie and fellow content creator Adeoluwa for August 2024 wey dem call, All of US.
She bin act for di thriller series as Ivy and also gbab credit of associate producer for di project.
She dey also run her own bag line, her clothing brand as well as work as housing agent for Nigeria.
Priscilla Ajoke Ojo