A former chairman of MTN Nigeria, Pascal Dozie, don die, di family confam
Founder of Diamond Bank Plc, wey no dey exist again and a former chairman of MTN Nigeria, Pascal Dozie, don die, di family confam.
Di family for statement wey dem release say dia patriarch die on Tuesday morning at age 85 years.
According to di representative of di family wey announce di death, Mr Pascal na good father wey get strong Catholic faith.
“Wit deep sorrow, but wit gratitude to God for a life well spent, we announce di passing of our beloved father, Pascal Gabriel Dozie, on 8th April 2025
“E be devoted husband, father, grandfather, and a man of unwavering Catholic faith. Im life dey marked by service to God, im family, and im kontri.
President Bola Tinubu and oda Nigerians pay tribute
President Bola Tinubu join oda Nigerians to mourn di passing of di patriarch.
For one statement from di presidency, di Nigerian leader describe Oga Dozie as “a rare breed business leader whose wisdom, humility, and pioneering efforts lay di foundation upon which many continue to build. Im passing na serious loss to di private sector and Nigeria.”
E be pesin wey believe say Nigeria plenty potentials dey important in shaping di financial services industry and expanding access to mobile connectivity nationwide. Im influential leadership pass corporate boardrooms, President Tinubu add.
Oga Tinubu pay tribute to di family, as e call ondi kontri private sector to honour Chief Dozie memory by upholding di values of integrity, innovation, and nation-building, wey pipo know am for.
Former Anambra state govnor Peter Obi for im tribute say im legacy as a banker and entrepreneur stand as testament to im vision, leadership, and commitment to excellence wey don inspire many individuals, and businesses.
Who be Pascal Dozie
Chief Pascal Gabriel Dozie na di founder of Diamond Bank and di first Chairman of MTN Nigeria. E be di pesin wey bin dey di forefront of two of di most transformative sectors for Nigeria development journey: banking and telecommunications.
Mr Pascal Dozie, CON na Nigerian entrepreneur, businessman and founder of Diamond Bank.
Dem born am for 9 April, 1939, for Egbu, Owerri, Imo state, south-east Nigeria.
Pascal Dozie start im career as an Economist for di National Economic Development Office for di United Kingdom. E also work as part-time lecturer for di North-western Polytechnic, London. Between 1970 and 1971, e serve as consulting economist for African States Consulting Organisation for Uganda.
Afta e quit im job for Uganda, Oga Dozie relocate to Nigeria at di request of im mother. Afta e return to Nigeria for 1971, wit im experience for Econometrics and Industrial Engineering, e launch im first company African Development Consulting Group (ADCG) wey later transform to Diamond Bank.
For 1985, dem appoint am Chairman of Progress Bank, wey later stop operation. Dat same year, Dozie bin apply for banking license to help traders for di South-Eastern Nigeria wey bin dey face banking issues. Dat na wetin bring about Diamond Bank.
E serve as di CEO of Diamond Bank from 1991 to 2006, then handover give im son Uzoma Dozie.
E don hold several positions in di past wey include one-time former Deputy Governor of di Central Bank of Nigeria, Past President of di Nigerian Stock Exchange,
E bin get shares for di MTN Group and serve as Chairman of di company