Reports from Nigeria don show say at least 60 pipo don die within one week sake of attack from unknown gunmen or suspected terrorists for di kontri.
Di worst one happun for Plateau, north-central, wia over 50 pipo die and more dan 1,000 pipo run comot from dia houses afta gunmen attack some communities for Bokkos Local Goment Area of Plateau State.
Dem later recover 40 more dead bodies on Wednesday and Thursday night as rescue team still dey search bush for pipo wey miss.
Di Chairman of Bokkos Cultural Development Council (BCDC) Vanguard, Farmasum Fuddang, tell Channels Television say dem bury 31 pipo togeda on Thursday. Five pikin wey dem burn for Hurti village still dey among. 11 pipo die for Ruwi village, four for Manguna, and one pesin for Daffo village.
National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, wey visit di state sake of di attack tok say Federal Goment dey try solve di security problem wey happun for Bokkos Local Goment Area of Plateau State, and bring permanent insecurity wahala for di state.
Bandits kill pipo for Katsina
For Katsina, northwest Nigeria, pipo wey dey for Funtua Local Goment Area say between Saturday and Sunday bandits enta some villages for di area, carry over 50 pipo wey include women and children.
Di attackers also kill at least six pipo, and later attack anoda place for Dandume Local Goment Area.
Malam Ya’u Cibbuna, one resident of Layin Garaa for Funtua, say, “Around 10:30 for night dem show, carry men, women, girls, married women and small children, total na 53.”
Katsina State Police say dem still dey investigate di mata, so dem no fit tok anytin until dem finish di work.
‘Take it Back’ protest across Nigeria – wetin e dey about?
Tariffs: Why ‘bloodbath’ dey on Asian markets?
Who be di candidates wey dey run for Anambra governorship election?
Again on Sunday, Lakurawa bandits kill at least 16 pipo for Kebbi State, northwest Nigeria, as dem attack Tungar Ladan and Tungar Taura communities for Augie Local Goment Area.
Police tok-tok pesin for Kebbi, CSP Nafiu Abubakar, confam di attack to BBC Pidgin.
E say di bandits, wey dem suspect say na Lakurawa, enter di two villages wit heavy weapons on Sunday.
“On 06/04/2025 around 6pm, suspected Lakurawa bandits wit plenty guns attack Tungan Taura and Tungan Ladan villages for Augie LGA, Kebbi State. Dem steal cows but di exact number no dey clear,” Abubakar tok.
Abubakar kon add say, “Naso 16 pipo die as pipo try stop di bandits wey dey escape wit di cows.”
E add say Commissioner of Police for Kebbi, CP Bello M. Sani don condemn di attack and don send more police and oda security pipo go di area make dem catch di pipo wey do am.
Why terrorist attacks dey increase for Nigeria dis days?
Expert don tok say na different reasons dey cause all dis attacks, and if goment no act fast, e fit even worse.
Dr. Yahuza Getso, wey be security expert for Abuja, break am down say e get like five reasons.
“First, goment no dey do anytin serious to punish pipo wey dem catch say dey involved, weda direct or indirectly, for insurgency and oda crimes,” Dr Getso tok.
E explain say criminal wahala for Nigeria dey in three parts: criminal clashes, banditry and religious wahala.
E add say second wahala be say goment no dey control di way guns dey spread anyhow for hand of pipo.
“Pipo wey dem arrest or catch say dem dey involved wit gun trade or armed deals, goment never handle dem well,” e tok.
E also tok say Nigeria no dey use intelligence work well.
“Our intelligence system don weak. Even criminals dey use intelligence beta pass our securities,” Dr Getso tok.
“Pipo wey dey give info don lose trust for authorities sake of fear say dem go kill or attack dem.”
E conclude say, if goment no do somtin fast, more attacks go still happun.
Di solution
Dr. Getso tok say many solutions dey to stop insurgency for Nigeria.
“Make goment dey responsible. Dem suppose get beta strategy wey go reduce competition among security agencies.”
“We sef as Nigerians, we suppose check oursefs, corruption too much. Like mysef, you, and securities, goment and evribodi wey dey involved.”
E still tok about wetin National Security Adviser Nuhu Ribadu recently yarn say plenty of di weapons wey dem find wit bandits come from goment armouries.
“Ribadu say highest percentage of guns wey dey wit criminals na from goment armoury dem steal am. Dis one show say we need serious improvement.”
Dr Getso add say Nigeria need to dey do proper risk cost analysis and use di results take plan beta.