Korean actor, Kim Soo-hyun don admit say e bin date di late 24-year-old actress, Kim Sae-ron for one emotional press conference.
For di press conference, e cry as e admit say e bin date di actress wey take her life last month.
E say e date her for ova a year privately, about four years ago but e no get anytin to do wit why she die.
E reveal how her family bin accuse am publicly say na im cause dia pikin death bicos e bin dey harass am to pay debt wey she bin owe dem.
Kim Sae-ron die on 17 February, 2025, for her house. Authorities later reveal say she take her life.
Di popular actress bin neva act since 2022 afta di kasala wey burst on top her career as dem find out say she bin dey drive under di influence of alcohol.
‘I be coward’
Oga Kim for di press conference wey im no allow tori pipo to ask am any questions, tok say, “e no dey true say she make di tragic choice bicos of me or my agency bin dey chase am ova debt”.
Oga Kim refer to imself for di press conference say im be “coward” afta e bin first deny say im and Kin Sae-ron get anytin togeda.
E tok say, “wen she post picture of us togeda wen Queen of Tears bin dey on air. I bin dey wit am for like one year, four years bifor dat drama show. But at dat time, I deny our relationship.”
“Whenever mata happun and na choice of weda to pick Kim Soo-Hyun di pesin or Kim Soo-hyun di celebrity, I tink say I dey always pick di celebrity. As di main actor for Queen of Tears I bin dey tink wetin go happun if I just comot outside admit say I bin dey a year long relationship”.
E reveal say even though im and di late actress bin dey di same agnecy wen di DUI tin wey crash her career bin happun for 2022, e bin no even fit to tok to am about wetin happun on top say dem be exes.
E say, “I bin hear say di former CEO of di agency bin dey go through hard time bicos of di case wen di drunk driving mata happun. But I know say, di late actress bin dey relationship wit anoda pesin. So I bin dey careful to contact am.”
E carry voice recording of phone calls come di press conference to prove say im or im agency bin no chase Kim Sae-Ron for money.
E say, “di family of di late actress, just bicos I be her ex-boyfriend, dey tok say na me push am to death. Dem dey demand make I confess for sometin wey I no do. Dem say you play am even from wen she be pikin so na you be killer.”
Kim Soo-Hyun bin categorically deny say e bin get anytin to do wit Kim Sae ron wen she be pikin.
Plenti kasala don burst for di actor life, since family member of late Kim Sae-ron come publicly to accuse am say e bin dey relationship wit dia pikin since wen she be fifteen years old.
Videos comot for social media as many companies bin dey comot dia advertisement wey get im face on top and tori be say dem don even cancel some projects wey bin dey in di running for am to feem.
Kim Soo-hun lawyer, Kim Jong-bok for di press release say “we don file complaint against di family of di deceased and Hoverlab operations and file for damages worth 12 billion won go di Supreme Central District Court”.
E tell di tori pipo for di room say di criminal investigation na di reason dem no take questions for di interview.
Who be Kim Soo-Hyun
Kim Soo-Hyun na actor wit almost 20 years of experience for di industry.
Some of di biggest dramas wey im don act na di 2024 Queen of Tears, 2020 Its Okay Not to Be Okay and Love From Another Star.
For 2011, e reveal say im fit get career for music if e want as e follow fellow actor and 2PM actor Ok Taec Yeon act for di musical drama series, Dream High wey run for two seasons.
For 2024, e pack five Awards for im role for Queen of Tears alone.
According to im management team, Gold Medalist e don win 25 awards since 2010.
Im agency also reveal say e bin dey involved in 10 series and three movies since im career start for 2007.
From di press conference we get say kim Sae Ron bin join Gold medalist for 2019 till her contract expire wit di company for November 2022.
Kim Soo-Hyun na 37 years.
Who be Kim Sae-ron wey die
Kim start her career as a child actor and pipo see her as one of South Korea most promising young actresses.
Dem born her for Seoul for 2000, she become popular wit her role for one 2009 film A Brand New Life – wey see her appear for di Cannes Film Festival.
Ms. Kim start her acting career wen she act in “A Brand New Life,” one film about one girl dem abandon for orphanage, in 2009. She be nine years old wen di movie premiere and dem bin invite her to di Cannes Film Festival.
She later feature for South Korea highest grossing film of 2010, The Man from Nowhere and 2012 thriller The Neighbour, and she receive award of recognition for dat feem.
She continue to appear for both big and small-screen productions, and she gada at least two dozen credits and she receive plenty South Korean acting awards.
Oda notable roles include di 2014 film A Girl at My Door and television roles like Mirror of di Witch for 2016.
For May 2022, Ms. Kim career bin suffer setback sake of one drink-driving accident. Dem catch her say she dey drive under di influence of alcohol.
Di car wey she dey drive bin crash into one guardrail and transformer, wey cut off electricity to dozens of nearby businesses for several hours, according to Yonhap News Agency, wey report say her alcohol level pass 0.2 percent.
Alcohol level wey pass 0.03 percent while driving dey considered as D.U.I. offense for South Korea.
Dem fine Ms. Kim 20 million won (£11,000) for April 2023.and she face serious backlash on social media from di public and influencers, wey condemn her behaviour as irresponsible.
Di actress bin issue apology on her Instagram account, she say “Excuse no dey for dis distasteful incident.”
At di time of di crash, Ms. Kim bin dey feem one Netflix series called “Bloodhounds” wey dem release for 2023.
But dem cut out most of her scenes from di final cut, according to di entertainment-industry publication Variety, sake of di driving accident. She no attend di promotional events wit di oda members of di cast.
Afta dat, she withdraw comot from public eye. Local media bin report say di actress bin dey try return to di entertainment industry in small-budget projects and one stage play.
Her last movie na still di Netflix 2023 Korean drama “Bloodhounds,” according to reports.