10.7 C
London
Monday, March 31, 2025

Wetin we know about di killing of Cameroon Sojas for Nigeria

Cameroon army don confam di killing of 12 of dia sojas for Wulgo Cameroon army don confam di killing of 12 of dia sojas for Wulgo

Cameroon army don confam di killing of 12 of dia sojas for Wulgo, northeastern Nigeria, for one attack by “jihadist terrorists”.

Dem say many odas wunjure for dis sad incident.

For inside statement on Wednesday, Army tok-tok pesin Cyrille Serge Atonfack say heavily armed insurgents storm one post of di Multinational Joint Task Force on Monday night 24 March to Tuesday 25 March, near Cameroon border town of Fotokol.

Di deadi body dem of those wey die for dis incident dem don send dem back home and wia dem keep dem for mortuary, while di wounded sojas dem carry dem go Chad for treatment.

According to di army, dem say dem “neutralise,” several jihadists although dem no give any specific number or name any group.

“Di dominance of terrorist groups around di Lake Chad Basin…dey largely due to dia apparent alliance wit powerful transnational criminal entities,” Capt. Atonfack tok.

Reactions to di killing of Cameroon sojas

Di killing of Cameroon sojas for neighbouring Nigeria don draw condemnation, condolences, and criticism within di kontri.

“Diz attacks, wey dem carry out wit disturbing ease and di number dey increasingly heavy for our nation, suggest say major management problems for di military high command,” na wetin opposition leader Maurice Kamto tok for statement.

Im add say “troop morale, wey be di primary lever for stimulating soja bravery, no be like say na preoccupation of the high command.”

Football legend and incumbent President of Cameroon football federation Samuel Eto’o, describe di dead sojas as “fallen patriots” wey defend di kontri freedom and integrity.

Meanwhile, U.S. Embassy for Cameroon also express solidarity wit Cameroonians, dem tag di attack on di sojas as “heinous.”

For more than a decade now, na im di Lake Chad Basin don dey crippled by attacks, kidnappings, and killings, mostly by jihadist groups like Boko Haram and Islamic State West Africa Province (ISWAP).

Despite di efforts of di Multinational Joint Task Force wey come from sojas from Cameroon, Nigeria, Chad, Benin, and Niger, d jihadists don succeed to continuously carry out dia violent activities.

Last year, Chad threaten to pull out of di collective security force, dem say e don don fail to stop insurgency around di Lake Chad Basin.

Since 2009, jihadist violence for northeast Nigeria don kill 40,000 pipo and displace 2.3 million, according to UN, di conflict don spill into neighbouring kontris.

Di Lake Chad region in particular — wey stretch across Nigeria, Niger, Chad and Cameroon — don become stronghold for jihadist stronghold, dis don affect fishing, farming and herding, wey 40 million pipo wey dey live dia dey depend on.

  • Niger swear in coup leader as president for five years
  • South Sudan VP Machar under house arrest, im party tok
  • 27 soldiers die afta gunmen shoot down UN helicopters for South Sudan

Latest news
Related news