Ukraine don tok say dem ready to accept immediate 30-day ceasefire wit Russia wey di US process afta just one day wey US-Ukraine bin tok for Saudi Arabia.
US Secretary of State Marco Rubio tok say dem go present di offer give Russia and say “di ball dey dia court” – Moscow neva tok come outside on top di mata yet.
Ukraine President Volodymyr Zelensky say na US hand e dey to try convince Russia to agree to di “positive” proposal.
Tuesday tok-tok for Jeddah na di first offical meeting between di two kontris since di ogbonge gbas-gbos between Zelensky and US President Donald Trump for di Oval Office on 28 February.
For joint statement, di US say dem go immediately restart intelligence sharing and security assistance to Ukraie wey Washington bin stop afta di public kasala wey gas for di White House.
Di US-Ukraine statement tok say, “both delegations don gree to name dia negotiating terms and immediately start negotiations wey fit lead to enduring peace, wey go give Ukraine long-term security”.
Rubio tok for press conference for Jeddah late on Tuesday say e hope Russia go accept di proposal.
He say Ukraine don “ready to stop shootinf and start talking”, and if Russia reject di offer “den we go unfortunately know wetin dey block peace for hia be.”
E say, “today we don make offer wey Ukraine don accept, wey be to enta ceasefire and go to immediate negotiations”.
E add say, “we go take dis offer now go Ukraine and we dey hope say, dem go say yes to peace. Di ball dey dia court.”
Trump special envoy, Steve Witkoff wey bin dey di Jeddah toks, suppose travel go Russia in di coming days. Dis na accordinf to source wey dey familiar to di planning tell BBC although tins fit sharparly change.
Dis offer of 30-day ceasefire pass wetin Zelensky bin propose wey be partial truce for di sky and for di sea.
Di Ukraine president thank Trump for “di constructiveness” of di tok-tok wey happun for Jeddah.
For video message, Zelensky say Russia gatz “show dia willingness to stop di war or continue di war”.
E add say, “time don come for full truth”.
Di Kremlin neva publicly respond but dem bin tok earlier on Tuesday say dem go issue statement afta Washington don tell dem wetin dem discuss during di tok-tok.
But influential Russinal lawmaker Kostantin Kosachev say any potential agreements go dey “on our terms, no be American”.
Kosachev wey be chairman of di Federation Council international affairs committee say, “real agreements dey still dey written… for di front”, as im add say Russian troops still dey advance for Ukraine.
Russia launch full-scale invasion enta Ukraine for February 2022. Moscow dey currently control about 20% of Ukraine territory.
For White House, Trump tell reporters say e go follow Russian President Vladimir Putin tok, and “hopefully” e go gree to di proposal.
Trump say, “pipo tok say e take two to tango” as e add sat dem go fit gree to di deal in di nest few days.
“We get big meeting wit Russia tomorriw and some beta tok-tok go hopefully happun”.
E add say e dey open to invote Zelensky come back Washington.#
Rusian Foreign Ministry tok-tok pesin Maria Zakharova tok sat Russia neva riule out toks wit US reps in di next few day, according to Russia state owned news agency Tass.
Tori pesin ask weda Trump and Zelensky relationship dey “back on track”, Rubio ansa say im hope say na “peace” dey back on track.
E tok say, “dis no be Mean girls or episode for tv show. Today pipo go die for dis war, dem die yesterday and sadly unless dia be ceasefire, dem go die tomorrow”.
Dis US and Ukraine teams bin meet afta overnight drone attacks wey kill at least three pipo near Moscow, wey Russia show as proof say Ukraine no wan use diplomacy end di war.
Trump and Zelensky don gree to finalise “as soon as possible” one critical mineral deal, na wetin di joint statement tok.
Ukraine don offer to grant di US access to dia rare earth mineral reserves for US security guarantee but di White House kasala spoil show.
Rubio sat di deal no be wetin dem tok on Tuesday but na wetin Ukraine and US treasuries negotiate.
Di US delegation for Jeddah bin also include US National Security Adviser Mike Waltz.
Di joint US-Ukraine statement tok Kyiv don repeat say Europe suppose dey inside any peace process.
Di shift for America approach to di war wey don iclude locking Europe out of tok don cause plenti emergency meetings between European leaders fir recent weeks.
Di EU Comissioner President Ursula von der Leyen say di bloc see wetin happun for Tuesday as “positive development”.
On Fridat, Trump bin issue rare threat of more sanctions against Moscow to take push for di deal. Russia already get plenti sactions from US bicos of di war.
Trump say e dey reason di move sake of say “Russia dey absolutely pound Ukraine for di battlefield right now”.
Meanwhile, di war still dey happun for ground on Tuesdat.
Three men die for di Moscow region for wetin dem de call di biggest drone attack for di Russian capital since di start of di full scale war for Ukraine.
Anoda 18 pipo wey include three pikin dem bin injure, na wetin health officials tell di Russian tori pipo.
Di Russian defence ministry say 337 drones bin dey blocked ova Russia nad 91 of dem bin dey shot down ova di Moscow region.
Ukrainian officials dey report Russian drone attacks on di capital Kyiv and plenti oda regions.
Ukraine air force say dem bin also shoot down 79 of di 126 wey Russia launch as well as one Iskander-M ballistic missile.
E no clear as at now weda any casualities bin dey.