10.4 C
London
Tuesday, March 4, 2025

One-year-olds dey among rape victims for Sudan civil war, UN tok

Warning: Dis tori get details of sexual kasala wet fit disturb some pipo

Armed men dey rape and sexually assault pikin dem wey young including one year olds for di Sudan civil war, na wetin di UN children agency, Unicef dey tok.

Di tin worry di survivors sotay dem wan take dia own lives.

Mass sexual violence don dey very well documented as weapon of war for di kontri wey dey inside war wey don dey go on for ova two years.

But Unicef report na di first time wey dem go tok in detail wetin di rape dey do to young pikin dem for Sudan.

One third of di victims na boys wey dey normally get “unique challenges” to report di crimes and find di help wey dem need.

Unicef tok say even though dem don report officially 221 rape cases against pikin dem since di war start, di true number fit dey much bigger.

Sudan na socially conservative kontri wey mean say ogbonge societal stigma no dey allow survivors and dia families to tok comot about rape as well as di fear of punishment from armed groups.

Di Unicef report show di terrible window of di abuse wey pikin for di kontri see for di civil war.

But wetin fit be di most shocking part na say 16 of di victims dem neva even reach five years old, including four small pikin dem.

Unicef no tok who dey responsible but oda UN investigations don put most of di blame for di rapes for di door of di paramilitary Rapid Support Forces (RSF).

Dem say RSF fighters get pattern wia dem dey use sexual violence take terrorise civilians and suppress opposition wey fit block dia advance.

Di RSF wey dey fight dis war against di former allies, di Sudanese Armed Forces say dem no do anytin wrong o.

Unicef executive director Catherine Russell tok say “pikin wey dey young like one year olds wey dey raped by armed men suppose shock pipo and make dem to act immediately.

Millions of pikin for Sudan dey at risk for rape and oda kain sexual violence wey dey used as weapon of war. Na ogbonge violation of international law and na war crime. E must to stop.”

According to evidence wey international human rights groups bring out, victims for di RSF stronghold of Dafur bin dey targeted becos dem be black Africans instead of Arabs and e be like dem wan chase dem comot Sudan.

Di UN humanitarian response to Sudan alreadi dey underfunded. Di new cuts for US aid dey expected to reduce programmes to help victims di more.

Di kain details wey dis Unicef report comot wit show say di mata don enta gear two.

One woman survivor, Omnia (no be her real name) wey armed men hold her plus oda women and girls, remember say, “afta nine for night, pesin go open door, dey hold koboko, select one girl, carry am go anoda room. I go hear as di small girl dey scream and cry. Dem dey rape her”.

“Evritime wey dem rape her, di girl go dey come back wit blood all ova her bodi. She still be small pikin. Dem go only release di girls for morning and dem go come back almost unconcious. Each of dem go cry and dia tok no dey make sense. For di 19 days wey I stay dia, e reach one time wey I wan end my life.”

Unicef say di attacks dey also get times wen armed men go enta houses and ask for di girls to dey surrendered and dem even rape some of dem for di front of dia loved ones.

Victims dey sometimes leave di experience wit serious injuries or unwanted pregnancies.

On top di 221 rapes wey Unicef report na anoda 77 cases of sexual assault against pikin dem, and most of those ones na attempted rapes.

Sudan as dem don dey broken sake of war, na one of di hardest places for di world to get access for services and frontline workers.

Mohamed Chande Othman wey be di oga of di UN fact finding mission wen dem drop earlier report wey bin dey released for Ocotber tok say, “di sheer level of sexual violence wey dey documented for Sudan dey staggering”.

Di majority of pipo wey dis war don pursue comot from dia house don make am say women and pikin dem dey more likely to dey attacked. Di UN say three out of four school age girls no dey school.

Trump government cuts don stop important help

Di sad result of dis crimes dem dey increased becos e no get too many places wey victims fit go for medical help. Dis na sake of say dem don destroy, loot and tiff tins for many of di medical facilities.

Di recent US aid cuts fit don endanger even di small services wey pikin dem fit use.

Unicef don dey provide safe spaces for pikin dem wit network of local activists wey dem arrange wetin dem dey call Emergency Response Rooms so dem go fit deal wit di kasala wey dey burst for dia yard.

Di activists bin dey rely on di US aid well-well and now most dey forced to shut down. Dis na according to one Sudan coordinating committee wey dey monitor dem.

Di UN joinbodi wey dia work na to protect women rights say local joinbodi wey women dey lead na im dey important to deliver support give survivors of sexual violence. But dem dey get less dan 2% of di total money wey dey di UN Sudan Humanitarian Fund.

Di BBC find out say at least one of di local groups wey dem dey call “She Leads” shut down by force wen US funding stop.

No be plenty money, about tens of thousands of dollars but bin allow case workers make dem fit reach about 35 survivors per month.

Dis na according to Sulaima Elkhalifa wey be Sudanese human rights defender wey dey run goment unit on combatting violence against women and don help organize private initiative.

She tell di BBC say, di pipo wey armed men don rape “no get di luxury to dey depressed”.

She add say wetin war dey need like di need to find food and di need to run no dey leave room to fit handle trauma.

Latest news
Related news