President of Ghana John Mahama don give im appointees up to 31 March to declare dia assets or im go punish dem.
Dis na afta im present im asset declaration form to di kontri auditor general on 18 February 2025.
Di kontri law for asset declaration under di public office holders act, dey provide say make public officers provide detailed account of dia assets, properties and oda liabilities bifor dem go enta public office.
John Mahama tok say “in di past, I go present dis form to di auditor general privately, but decide say dis time I go present am for public to show transparency for dis process.”
“I don maintain say to punish corruption, we gatz prevent di act from happening in di first place, no be only to punish corruption afta e don happun.”
Na so im add say im give im appointees up to 31 March to declare dia own asset or dem go face punishment wia fit include sacking from office.
Public officials gatz publish dia assets afta dem declare am to di auditor
Sabi pipo don chook mouth for di mata about asset declaration.
Currently, di law don tok say pesin gat to complete and submit written declaration of all dia property or assets wia dem get directly or indirectly on top on form, to di auditor general.
Di law no dey allow say make even di auditor open di envelope wia get di information unless time don reach wia sakala don happun about a particular pesin wia dem go open am.
Na so sabi pipo tok say dat na wrong tin.
Sake of since di auditor no fit to open di documents, pipo fit submit incomplete documents or odas go stuff di envelope and present to di AG office.
Di Ghana integrity initiative bin dey on dis crusade say make politicians and oda public officers go beyond declaration to publish dia assets so say everibodi go know di properties dem get bifor dem go enta office and when dem comot office, wetin dem get.
“We don dey call for asset declaration regime wey ensure say di public officers go publish dia assets wey di auditor general go verify dem bifor dem go enta public office,” madam Mary Adda wey be executive director for di anti-corruption organisation don tok.
Dis go help to deal wit corruption wia e go address di issue of public officers wia don dey use dia office to make moni to buy properties wia dem sometimes dey register dis assets in di name of dia children.
Three times oda African presidents publish dia assets
In 2024, current Senegal president Diomaye Faye bifor im contest dia election, declare all im assets.
According to di document of im assets wia im publish on top im social media pages, in tok day im get 2 second-hand cars, 2 houses, 2 bank accounts and some farms.
Im add say im bin dey owe one of im friends way in collect loan to develop one of im farms.
Oga Faye also disclose say di house wia im dey stay at di time im dey contest di elections, na im build am by imserf as im enta public service as a tax officer.
Im also challenge all di oda contenders say make dem declare and publish dia assets ahead of dat election in March, but none of di candidates do am.
Many pipo don tok say Diomaye Faye don set good example for African presidents and politicians.
One of im campaign promises na to fight corruption, na so im start am so.
For Liberia, di President Joseph Boakai suspend more dan 450 goment officials wey fail to declare dia assets to di kontris anti-corruption agency.
Di president tok say dis goment officials no go receive pay for one month or “until dem submit di declarations.”
Di law for Liberia dey require say all public officers go declare dia wealth bifor dem go take up dia post and when dem leave goment.
Bifor im inauguration as president in 2024, President Boakai declare im own assets wey im publish am.
Inside im asset declaration document, di president tok say im get cars, cows and pigs worth $212,400.
Im tok say im net worth minus liabilities na $970,419, wey im commercial and residential properties in total dey cost $766,391.
Im also get $61,295 cash for two banks for di kontri.
In 2015, then Nigeria president Muhammadu Buhari declare im assets as im preach transparency.
Im declare sat im get $150,000 for im personal account wey im get 5 houses and two mud houses.
Buhari also tok at di time for im declaration say im get orchard and ranch wit 270 cattle, 25 sheep, 5 horses and oda birds.
Im also gat shares inside three companies and two plots of land wia dem neva develop.
Di president also say im buy two cars wit im savings.
Pipo don tok say African presidents gat to be transparent wit dia pipo and declare dia assets bifor after afta dem leave public office.
Dis na one of di ways to get di trust of di pipo.
Ova di years, Ghana don dey fall for di corruption perception index by transparency international.
Di 2024 ranking of di index wia dem release on Tuesday 11 February 2025, show say Ghana don drop from di score of 43, to 42 out of clean score of 100, from 180 kontris across di world.
Dis na drop from di 2023 score of 43, wey don dey raise questions about di fight against corruption.
Di Ghana integrity initiative (GII) don tok say wit dis latest ranking, Ghana gat to take some action.
Among oda tins, GII tok say parliament gat to improve dia financial oversight responsibility wia di judiciary gat to set up special anti-corruption court wia go handle corruption cases like e dey happun for Tanzania.
Sabi pipo want make public officers go beyond declaration to publish details of di assets
Bassirou Diomaye Faye publish all im assets bifor im win di Senegal presidential elections in March 2024
President Boakai don suspend public officers for one month as dem fail to declare dia assets
When im become president in 2015, Buhari declare im assets wia im publish am for transparency