11 C
London
Saturday, February 22, 2025

Why Ghana prosecutor office remove ex-finance minister Ken Ofori-Atta from wanted list

Di ex-minister don give di prosecutor between 14-31 May to return to di kontri to face investigation Di ex-minister don give di prosecutor between 14-31 May to return to di kontri to face investigation

Di special prosecutor of Ghana don remove di kontri ex-finance minister Ken Ofori-Atta from di wanted list over corruption investigations.

Oga Kissi Agyebeng last week bin tok say di former minister ‘na fugitive from justice’ sake of im comot di kontri as dem dey investigate am for im role in plenty goment contact as im be minister from 2017-2023.

For one press conference, di prosecutor tok say, “di minister get questions to answer ova some contracts like di PDS contract for di kontri electricity company, di procurement of contractors and materials and oda payment for di national cathedral project, contract by di ministry of health for 307 Mercedes Benz ambulances and contract by di Ghana revenue authority to SML for transaction audit.”

Lawyers for di former minister bin exchange letters wit di prosecutor wey dem tok say di minister go dey out of di kontri indefinitely.

Na so di prosecutor tok say im no go accept dat kind excuse wia “di ex-minister neva satisfy di office say im medical condition no fit make am travel to Ghana to answer di questions.”

Di lawyers, according to di prosecutor Kissi Agyebeng only present one letter from one ogbonge hospital for di US wey tok say dem dey monitor di minister to see if dem go make am undergo some surgery.

Days afta dem declare di former minister wanted, officials of di opposition party, wia im be member of, tok say im dey traumatised.

“Di minister Ken Ofori-Atta don dey traumatised by how dem label am as wanted fugitive. Im comot di kontri wit permission wia im go make imsef available for investigation,” di minority leader Alexander Afenyo Markin tok for parliament a day afta dem declare di minister wanted.

Meanwhile, prosecutor don remove di ex-minister on top wanted list.

Inside one statement from di prosecutor’s office on 18 February dem tok say lawyers for di ex-minister don write to dia office to give date wey im go return.

“Dem give us definite date wen di minister go come meet us and answer di questions, na so we don reschedule di meeting wit di ex -minister.”

Minority leader for parliament oga Alexander Afenyo-Markin tok say “di ex minister go return between 14 – 31 May 2025 to answer di questions.”

But di prosecutor office tok say even though dem remove di ex-minister on top di wanted list, dem go put am back if im fail to return to di kontri and meet di prosecutor during dat time dem gree.

“If Ken Ofori-Atta no return within di date im give us to return, we go carry am put on top di wanted list again wia we go consider say im na fugitive from justice.”

“Di OSP go carry all legal steps to ensure say im return to di kontri and face di prosecutors,” oga Kissi Agyebeng add.

Ghana bin dey under $3bn IMF programme, to deal with di kontri economic crisis.

During di tenure of di ex-finance minister, sabi pipo and di opposition party tok say im supervise di crisis.

Eighty lawmakers for im own party, di goment NPP for 2022 write petition to di president at di time, Nana Akufo-Addo, say make im sack di finance minister Ken Ofori-Atta, wey be di president cousin from office, otherwise dem no go be part of goment business for parliament.

For one press conference, di MPs tok say “di economy don spoil, na so if you no sack dis minister, we no go dey parliament wen di goment dey present di budget,” leader of di caucus Andy Appiah Kubi tell journalists.

But di president at di time tok say im no go sack di minister, unless im finish dey negotiate di IMF deal for di kontri.

Di special prosecutor say im get questions to answer in five contracts wey im sign as im be finance minister from 2017 – 2023

Kissi Agyebeng tok say if di minister fail to appear bifor di office between 14 – 31 May, dem go carry am put di wanted list again

Latest news
Related news