11 C
London
Saturday, February 22, 2025

Pope Francis get pneumonia for im two lungs, Vatican tok

One Vatican statement say di Pope One Vatican statement say di Pope

Pope Francis don develop pneumonia for im two lungs and im condition still dey “complex”, di Vatican tok.

Di 88-year-old don dey suffer from one respiratory infection for more dan one week and e dey on admission for Rome Gemelli hospital on Friday, 15 February.

“Di follow-up chest CT scan wey di Holy Father do dis afternoon… show say e get bilateral pneumonia, wey require additional drug therapy,” di Vatican tok.

Dem say lab tests, chest X-ray and di Pope clinical condition “still dey critical”.

Even wit im health condition, di Vatican say di pontiff still dey in “good spirits” and e spend di day “reading, resting and praying”.

Pope Francis also express im gratitude to well-wishers and ask dem to “pray for am”.

Bifor im admission last week, di Pope bin get bronchitis symptoms for several days and e delegate officials to read prepared speeches for events.

E suppose lead several events ova di weekend for di 2025 Catholic Holy Year wey run through to next January, however, dem don cancel all di public events on di Pope calendar through to Sunday.

On Monday, the Vatican say doctors don change di Pope drug therapy for di second time during im hospital stay to tackle wetin at di time dem tink say na “polymicrobial infection of di respiratory tract”.

Di Pope especially dey prone to lung infections as e develop pleurisy wen e be adult and dem remove part of one of im lungs wen e be 21.

During im 12 years as leader of di Roman Catholic church, dem don hospitalise di Argentine plenty times including for March 2023 wen e spend three nights for hospital wit bronchitis.

Wetin be Pneumonia?

Pneumonia na inflammation of di lungs, na infection mostly dey cause am.

Most pipo dey get beta in 2 to 4 weeks, but babies, older pipo, and pipo wit heart or lung conditions dey at risk of getting seriously ill and fit need treatment for hospital.

Di symptoms include:

. Cough

.Shortness of breath

.High temperature

.Chest pain

.Making wheezing noises wen you breathe – babies dey make grunting noises

.For older pipo, e dey common make dem dey confused

.Loss of appetite

.Tiredness

.Aching body

Latest news
Related news