Damaged plane of Delta Airline wey crash for di runway for Toronto Pearson Airport after di crash
“Our plane crash. E dey upside down.”
Dis na di words of John Nelson, passenger for di Delta Air Lines flight wey just crash and turn upside down while e dey land for Toronto Pearson International Airport.
All 80 pipo wey dey on board di flight from Minneapolis – 76 passengers and four crew – survive, di airport chief executive tok.
Eighteen passengers injured. Local paramedics say three pipo – one child, one man for im 60s and one woman in her 40s – dey seriously injured, but officials say dem no know say anybody get critical injuries.
“Most pipo appear to dey okay. All of us dey come down,” Mr Nelson tok inside one video dem post for Facebook after di crash.
E later tell CNN say sign bin no dey of anything unusual before landing.
“We slide on our side, den e tumble,” e tok, adding say “big fire ball come out of di left side of di plane”.
Passengers bin dey hang upside down for dia seats.
“We bin dey upside down hanging like bats,” Peter Koukov, wey bin also dey on di plane, tell CNN.
Mr Nelson say e bin fit unbuckle imself, push imself to di ground.
“Some pipo bin dey hang and and need some help … and odas bin dey able to get down on dia own,” e tok.
Video footage wey dey shared on social media show pipo dey comot di aircraft wey dey upside down, with fire crews wey dey spray am with foam.
Di video show as airport staff dey help passengers out of di plane doors, with some of dem dey run comot from di plane entrance.
Despite say di plane slide for di runway, Diane Perry say she hear of di crash hen her family call her while she bin dey in line to check her luggage.
“E be like irony say we bin dey airport and no know say crash happen outside,” she tell BBC.
Di reason for di crash no dey clear yet. Two runways go dey closed for several days for investigation and dem don tell passengers to expect some delays.
Mr Nelson still dey process wetin just happen, e tell CNN say e dey “stressed, nervous, and still dey shake”.
“E dey amazing say we still dey here.”
Di crash na at least di fourth major aviation incident for North America in di past month – including one deadly in-air collision between one passenger plane and one military helicopter near Washington DC Ronald Reagan airport, wey kill all 67 pipo on board.