Nigeria na di African kontri wey get di second highest number of citizens wey US
Di Nigeria goment don announce say di first batch of Nigerians wey di US goment don deport, go arrive Nigeria dis Monday, 17. February 2025.
Dis na according to Bianca Odumegwu Ojukwu, Minister of State for Foreign Affairs for a post wey she make on social media.
Ojukwu say she meet wit di United States Ambassador to Nigeria, Richard Mills Jr, and she highlight di concern of di Nigeria goment about di decision of President Donald Trump to deport many Nigerians back to di kontri.
“As at now, na about 201 Nigerians currently dey detained for US immigration centres, and about 85 (of dem don dey) cleared for deportation. Di figure dey expected to rise sharply,” Madam Ojukwu tok.
For her discussion wit di US ambassador, Ojukwu tok say she maintain say “dis deportations, particularly for individuals wey no get history of violent crime, no suppose dey traumatic or sudden and say di individuals need to dey given enough time to handle dia assets rather dan say dem go just bundle dem enta planes and repatriate dem”.
“Di forced removals of our citizens from US soil must dey in compliance wit internationally prescribed guidelines and established protocols in dis regard and a more humane process supposed dey followed,” Ojukwu tok.
She tok say di ambassador give am im word say “di repatriations go dey done wit dignity and respect for human rights”.
At least, ova 3,000 Nigerians wey no get legal documents to stay for America dey face risk of deportation, according to one document wey Fox News get from di United States Immigration and Customs Enforcement and Removal Operations (ICE).
Fox News bin report on Tuesday 28 January, 2025 say di Nigerian immigrants don dey ICE non-detained docket wit final orders of removal since November, 2024.
Reports say Nigeria na di second highest number of citizens wey dey scheduled for deportation for Africa, followed by Somalia, Ghana, Senegal, among odas.
US Ambassador to Nigeria Richard Mills Jr, and Nigerian Minister of State for Foreign Affairs Bianca Ojukwu bin meet on Monday for Abuja