Di vaccination na for pipo wey be one year and above
Di Ghana health service don begin to vaccinate pipo against cholera for di kontri afta ova 50 pipo don die.
So far at least five out of di kontris 16 regions of Ghana don confam cases of cholera as hospitals dey struggle to deal wit di outbreak.
Many oda pipio bin dey on admission.
Data from di health service and ministry of health don show say for di greater Accra, Eastern, Central, Ashanti and Western regions na di regions wey don record cases.
Dr Denis Laryea wia be oga in charge of disease surveillance don tok say “pipo bin dey die sake of many pipo wia get di disease try to self-medicate, wia odas bin dey report to di hospital three to four days afta di infection.”
Na so dem begin to vaccinate pipo for di greater Accra region between 14 -17 February 2025 as im be di region wit di most cases – more than 200 out of di 6,000 cases across di kontri.
Di western and central regions also gat plenty cases.
For three days, di Ghana health service say dem dey target 300,000 pipo for dis vaccination for Accra.
Di areas for dis vaccination na di Ablekuma south, Okaikwei south and ashiedu keteke, all for di greater Accra region.
Who qualify for dis vaccination
Di health service say di oral cholera vaccine (OCV) na for every body wey be one year and above.
Dem also tok say di vaccine dey safe and effective
“Make una look for your area for di vaccination team, and take di vaccine to protect yourserf,” di health service tok.
Di world health organisation don tok say cholera na “highly contagious illness wia be global health threat. If dem no treat am, cholera fit to lead to death,” country director for di WHO Frank Lule tok.
For dis round of vaccination, di GHS say dem go do house-to-house and target districts wey be hotspots.
Symptoms of cholera
Di Ministry of health bin dey educate pipo since last year ova di illness.
Dem tok say to know say di sickness una dey see na cholera, di patient go get
– diarrhoea (wen pipo go dey poopoo water water)
– Vomitting
– Patients go dey thirsty, tired and weak
– Loss of body fluids wia fit lead to death
Cholera dey spread by flies, water and food.
E dey transfer from faecal matter to pesin mouth.
If pesin drink water and food wey contaminate, im fit sick of cholera
How to prevent cholera
According to di health service
– pipo gat to drink clean water
– Wash your hands with soap and running water
– Wash fruits and vegetables well well
– Practise good hygiene
– Eat food wey hot
– Make pipo stop open defecation
– If pesin get acute diarrhoea dem gat to drink ORS quick and visit di hospital
– Pipo wia dey sell food gat to wash plates, cups, and oda tins well well