11 C
London
Saturday, February 22, 2025

Why Trump dey cut aid to South Africa sake of land reform bill

President Trump don sign executive order wey go officially stop all aid to South Africa.

Im dey claim say di new land law for di kontri dey violate di human rights of di minority white pipo wey dia population get.

Oga Trump say di kontri new Expropriation Act go allow goment to collect farmland wey white pipo get without compensation.

Im don already tell im Cabinet to come up wit a resettlement program for Afrikaners wey im claim say, “be victims of unjust racial discrimination”.

Afrikaners na one ethnic group wey come from European — primarily Dutch — colonizers.

“South Africa dey collect land, and dey treat certain classes of pipo VERY BADLY,” President Trump write for im Truth Social account.

Im close adviser Elon Musk, wey dem born for South Africa, also join for di criticism – im dey ask ontop X why President Cyril Ramaphosa dey “open racist ownership laws”.

Why land na big issue for South Africa?

More dan thirty years afta apartheid end, land ownership for South Africa still be one issue wey dey veri sensitive and e dey make pipo vex well-well.

Land reform dey central for di transformation agenda of di kontri since democracy start for 1994.

Di expropriation law wey dem just sign dey serve as a reminder of how dem bin collect land from di black majority by force, and na di former racist apartheid goment bin do am.

Under di 1913 Natives Land Act, land ownership for black pipo bin dey limited to just 7%. Dem later amend am to 13% under di 1936 Native Trust and Land Act of South Africa.

Diz laws bin open di door for white pipo to own nearly 90% of land, while di black majority bin dey struggle to get a portion from di small wey remain.

Sake of dis, dem bin relocate black pipo to crowded homelands wia dem bin build poorly planned townships.

As a reminder of past injustices, dis week South Africa mark dia 70th anniversary since di apartheid regime bin remove 65,000 black pipo from dia homes by force, to make way for a suburb wey ‘only whites’ go stay.

Wetin di new law tok?

Di primary aimof di new law na to redress di historical inequalities, as dem dey promote economic growth.

E go allow di goment to take land for public good like infrastructure development, including building roads and homes, while dem go make sure say dem compensate and treat dem fairly.

Di new law dey replace di pre-democratic Expropriation Act of 1975, wey bin make am compulsory for di state to pay owners of diland wey dem wan take from dem under di principle of “willing seller, willing buyer”.

Instead, dis act need fair compensation for land wey goment seize for public good and use, apart from dat, for certain specific circumstances wia dem consider “just and equitable and for public interest” dem no go pay am.

Dis include property wey dem no dey use and dem no get any intention to either develop or make money from it, or wen e pose a risk to pipo.

For dis circumstances, di law wey bin tok say no collecting of land by force, go occur witout due process and fairness.

Who be di owner of South Africa land?

Although apartheid end more dan thirty years ago, white pipo still dey control most of di farm land for di kontri.

Current statistics show say white pipo get three quarters of privately-owned land, while di same race make up less dan 10% of di overall population.

Only about 14% of di land na im goment get.

Why di new law dey make Trump vex?

Even though di new law dey clear say goment fit seized land without compensation only under certain circumstances, di whites community for South Africa believe say di law don give goment free power to seize private residential properties.

Di pipo wey dey against di law draw comparisons wit land redistribution policies for Zimbabwe wia dem bin force thousands of white farmers to comot from dia land, many times wit force, between 2000 and 2001.

Di aim of di lands wey dem bin seize dat time na to redress di colonial-era land grabs but e contribute to wetin make di economy of Zimbabwe fall.

Na di right -wing civil rights group AfriForum di do tok-tok against di new South African law, wey dey mainly focus on di interests of Afrikaners.

Di group bin lobby for international support bifor and afta dem bin sign di Expropriation Act into law last month.

Di group claim say di new law no go guarantee di protection of property rights.

But di ANC dey blame AfriForum for misinformation and di way dem sey spread fear.

Instead, President Cyril Ramaphosa bin say di new law dey similar to di legislation for di US.

“Like di United States of America and oda kontris, South Africa bin don always get expropriation laws wey balance di need for public usage of land and di protection of property owners,” im tok.

For one surprising turn of events, Trump don give refugee status to white South African farmers wey dey “escape from goment sponsored race-based discrimination”.

Di realitybe say most Afrikaner dey do well for South Africa. Many don go social media to reject Trump offer of relocating to di US.

Di Afrikaner organisation Orania Movement tok say dia members bin no get ambitions to leave dia homeland and dem no want to become refugees for anoda kontri.

Orania na small town for di Karoo region wey dem bin establish to preserve Afrikaner culture and e get dia own currency.

How much be di financial help wey South African dey get from di US?

President Trump executive order dey freeze nearly $440 million in US financial aid to South Africa.

But di US embassy for South Africa don confam say di PEPFAR funding wey make up to 17% of di HIV/AIDS programme for di kontri no go dey affected.

Wetin Julius Malema bin tok?

Julius Malema, di leader of di radical populist Economic Freedom Fighters, bin reject Trump claim about di new land reform bill, wey describe am as an attack on di sovereignty of di kontri and a blatant display of imperialist arrogance.

Na dis tok vex Elon Musk to highlight di past of Malema wia im bin dey sing controversial songs bifor, including “Dubul’ibhunu – shoot di Boer”, wey im describe say dey cause violence.

For 2010, dem bin put Malema put on trial for singing di song.

Dem bin declare di song as hate speech, but High Court for Johannesburg bin later rule say di song no be hate speech or e no dey provoke pipo to violence.

Latest news
Related news