11 C
London
Saturday, February 22, 2025

I no get belle for any govnor

Television Reality Star Nengi Hampson Television Reality Star Nengi Hampson

Television Reality Star Nengi Hampson don react to tori wey dey fly up and down say she get belle for one state govnor for Nigeria.

Tori bin spread on social media on Tuesday, 8 February say di Big Brother Naija season 5 star get belle for one govnor.

Nengi for her reaction confam say true-true she get belle but no be for “any govnor”.

For her X account, she post say, “As much as I believe say social media lies no worth my time, I don accept am say we dey live for world wia pipo dey quick to spread lies and dem no dey know wen to stop. So I go make am clear, I no get belle for any govnor.”

Nengi na one of di housemates for Nigeria biggest reality TV show. She finish as di second runner up for di lock-down edition of di BBNaija 2020 show.

She bin feature for di show for di Lockdown edition of di show for 2020 .

Afta di show, Nengi move on to become Senior Special Assistant on Girl Child Development to Bayelsa state Govnor Douye Diri.

Nengi be also entrepreneur and brand ambassador. She be di owner of Shoes by Flora.

Nengi bin say she get passion to support girl child to di best of her ability and she wan also use her voice to fight gender based violence based on say she don experience am first hand.

Latest news
Related news