Authorities for UK don issue Red weather warnings and dem ask millions of pipo to stay for house as Storm Éowyn dey tear across di kontri.
Northern Ireland and parts of Scotland dey experience di worst of di weather and dem don dey issued wit di red warnings – wey mean say di high winds dey dangerous to life.
Authorities record wind gusts of up to 93mph (150km/h) for Aberdaron, north Wales, on Friday, while di Republic of Ireland see dia strongest winds ever recorded.
Di Republic of Ireland see dia strongest winds ever recorded, wia more dan 700,000 properties dey without power.
Hundreds of thousands of homes dey without light, hundreds of flights, train and bus services also dey cancelled.
Dem don close all di schools for Northern Ireland and for most part of central Scotland, while flights, buses and trains don dey cancelled.
Red warnings, amber and yellow warnings for wind, rain, snow and ice also dey across UK ova di next few days.
Red na di most serious weather warning wey di Met Office fit issue, wey mean say dem dey expect dangerous weather and urge pipo to take action to keep themselves plus odas safe.
Di red warning for di whole of Northern Ireland bin come into force at 07:00 GMT – e affect di morning rush hour – and continue until 14:00 on Friday.
240,000 properties dey without power for Northern Ireland – and di number dey expected to rise, NIE Networks tok.
‘Eye of di storm’
Northern Ireland dey for “di eye of the storm” with a real threat to life and property, First Minister Michelle O’Neil said.
More than 93,000 homes and businesses dey without power for Northern Ireland afta “widespread damage” to electricity network, according to NIE Networks.
Dem also don suspend bus and train services for there, all schools don dey advised to close and Belfast International airport dey warn of significant disruption to flights.
Police Service of Northern Ireland say di storm na “exceptional weather event” and e dey expected to bring di strongest winds wey dem dpn ever experience for di region since 1998.
Irish Republic weather service Met Éireann don also issue severe red weather warnings for di middle of potential “hurricane force winds” – BBC Weather also say e fit be Ireland storm of di century.
Authorities also issue red weather warning for di Isle of Man sake of di “violent storm force winds”, wey dey in place until 14:00 GMT, goment tok.
Ferry operators wey include Irish Ferries, Stena Line, and Calmac gatz cancel numerous crossings on Friday becos of di conditions for di Irish Sea and di west of Scotland.
Di centre of Storm Éowyn – pronounced AY-oh-win – dey for di north-west of Northern Ireland.
One very powerful winds dey blow for di west coast of di Republic of Ireland, where dem record a gust of 114mph (183km/h) for Mace Head in County Galway at 05:00 GMT.
Dis make am di strongest recorded gust of wind for Ireland, e pass di previous record dem set for 1961 during Hurricane Debbie.
Places wey warnings dey issued for UK
Currently, 13 warnings dey issued for UK warnings:
. Red warning for wind for Northern Ireland from 07:00 until 14:00 on Friday
. Red warning for wind for Scotland central belt and south-west from 10:00 until 17:00 on Friday
. Amber warning for wind across all of Scotland, north-east England, north-west England and Northern Ireland from 06:00 to 21:00 on Friday
. Amber warning for wind across parts of Scotland from 13:00 on Friday to 06:00 on Saturday
. Yellow warning for wind across most of di kontri from midnight until 23:59 on Friday
. Yellow warning for rain in parts of Wales, di South West and West Midlands from midnight to 09:00 on Friday
. Yellow warning for wind for parts of di Midlands, east of England, London and South East England from 05:00 to 15:00 on Friday
. Yellow warning for snow for parts of Scotland, for parts of di North East, North West from 06:00 until 23:59 on Friday
.Yellow warning for snow and ice for Northern Ireland from 19:00 on Friday until 10:00 on Saturday
. Yellow warning for wind in parts of Scotland from midnight until 15:00 on Saturday
. Yellow warning for ice for central and south-west England and central and southern Wales from 03:00 on Saturday until 10:00
. Yellow warning for wind for di western side of England, all of Wales and
Northern Ireland and south-west Scotland, from 08:00 on Sunday until 15:00
. Yellow warning for rain for di south-east and south-west, Wales, Midlands,
East of England and North West from 08:00 on Sunday until 06:00 Monday
Storm Éowyn na di fifth named storm of di season.
Na one powerful jet streams wey dey push low pressure towards di UK and Ireland ova di Atlantic Ocean cause am – afta one recent cold spell ova North America.
‘Weather bomb’
On im journey across di Atlantic, Storm Éowyn bin undergo one process wey dey known as “explosive cyclogenesis” – dem dey sometimes call am “weather bomb”.
Dem dey use di term describe area of low pressure wey dey deep by at least 24 millibars in 24 hours.
Storm Éowyn bin go deep by 50 millibars in 24 hours – more dan double di criteria.
Explosive cyclogenesis generally na sign of storm wey go bring extremely strong winds wit damage and disruption.
E also dey possible say di west coast of Ireland dey hit by a “stingjet”.
Dis fit occur in powerful storms where strong winds higher in di atmosphere dey forced to di ground and e go result in wind speeds in excess of 100mph.
Dem dey normally detect stingjet on satellite image as di hook – or sting for di tail – to the southern side of the storm.
Dem dey normally occur as storm system reach dia most powerful stage and e fit last for three or four hours bringing di most damaging winds.
During di devastating 1987 storm for southern England, sabi pipo reason say na stingjet dey responsible for di strongest gusts.
But, for di late 1980s, dem no know much about am as high resolution satellites no dey to help identify dem.