Di Prime Minister of Israel, Benjamin Netanyahu don confam say im kontri and Hamas don agree a ceasefire deal, but di security cabinet go meet later dis Friday to vote on weda to agree to di deal wey go see Hamas release about 30 Israeli hostages.
Netanyahu bin delay di meeting wit im cabinet afta e accuse Hamas say dem dey try to change di final agreement.
Israel security cabinet na one small inner group of ministers within di larger govment cabinet.
A statement from Netanyahu office tok say dem don update di families of some of di hostages and preparations don start for di hostages to return to Israel.
Wen dem bin reach di ceasefire agreement for Qatar earlier dis week, e bin cause big celebrations for Gaza.
However, continued bombardment from Israel kill don more dan 100 people for di Gaza Strip since di announcement of di ceasefire, according to di civil defence agency for Gaza.
Tok-tok pesin of di agency Mahmoud Basal say di pipo wey die for di airstrikes include 27 children and 31 women, while more dan 264 bin wunjure.
Plenty of Israel ministers dey expected to support di deal – but some far-right politicians dey threaten to resign if e go on, including Security Minister Itamar Ben-Gvir.
Another politician, Ohad Tal, wey dey chair di far-right Religious Zionist party for di Israeli parliament, dey also strongly oppose di deal. E tell BBC say im and members of im party dey consider to comot from Benjamin Netanyahu’s coalition goment.
“We want to make sure say di implication go be say we go return to fight Hamas, and we get plan on how to finish di job, how to make sure say Hamas go dey eliminated”, Tal tok.
E add say im and im colleagues go continue to stay for goment if dem dis guarantee, but e no go make sense for dem to keep staying if dem no get am.
Donald Trump influence
Donald Trump don make impact for di Middle East even bifor e officially start im second term as president of di United States.
E don cut thru di delay tactics wey Netanyahu and im coalition partners bin dey use to avoid accepting di ceasefire deal wey Joe Biden put on di table since May last year.
US pressure on Hamas and di oda Palestinian groups na given, but under President Biden, pressure on Israel no too dey.
On di other hand, Trump go start im second term claiming credit for getting di ceasefire deal in Gaza done. He go dey bask in glory.
Netanyahu, on im part, dey deal wit serious coalition crisis. Di whole idea of doing a deal wit Hamas na something wey di ultranationalist politicians who dey support Netanyahu goment no even wan hear at all.
One of dem, di national security minister Itamar Ben-Gvir, say im party – Jewish Power – go only support di goment if dem resume di war, cut off all aid to Gaza and destroy Hamas. If dat one no happen, im go resign.
Dat one no go dey important to Donald Trump. Di push for a Gaza ceasefire don show say Trump go put di interest of im presidency first bifor di political requirements of di Israel prime minister.
Di ceasefire go still start on Sunday?
Wen mediators – Qatar and US – first announce di deal, dem tok say di agreement go come into effect on Sunday, pending Israeli cabinet approval.
But afta Prime Minister Benjamin Netanyahu delayed di security cabinet vote from Thursday to Friday, accusing Hamas of trying to “extort last minute concessions”, reports say e fit reach until Monday bifor di first hostages go dey freed.
Time still dey on Friday for di security cabinet to meet and approve di agreement before di Sabbath go start. Jews no dey do anything for Sabbath.
Religious exemption sha dey for pesin to work on di Sabbath, if e go save a life. But as for now, e no dey clear wen di deal go come into force.
Two hardline right-wing ministers – Itamar Ben Gvir and Bezalel Smotrich – wey dey oppose di ceasefire deal tok say dem go resign in protest, but dem no go join di opposition to bring down di goment, so long as di war go resume afta six weeks, wen phase one of di ceasefire and hostage release deal go end.