Wia dis foto come from, Justina Nelson/LinkedIn
Ghana President John Mahama don submit di names of di first batch of regional ministerial nominees give di Parliament for approval.
For one statement wey di tok-tok pesin to di president, Felix Ofosu post on X on Tuesday,14 January, say di administration of di West Africa don unveil di first batch of di regional ministers.
Di document contain di names, details and portfolios of di 10 regional ministerial nominees wey di presidency send to di parliament for approval.
Three out of di 10 regional ministerial nominees na women.
Ghana get 16 regions, e neva dey clear wen di second batch wey go get di list of di remaining six regional ministerial nominees go comot.
Dis dey come few days afta President Mahama submit di second batch of ministerial nominees wey go serve for im administration give di parliament.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post
Dr. Frank Amoakohene – Ashanti region
President Mahama nominate Dr. Frank Amoakohene as di regional ministerial nominee for di Ashanti region.
Amoakohene na medical professional and youth leader. E be expert on healthcare, governance and public service.
E get Bachelor of Medicine and Surgery from di University of Ghana, Doctor of Medical Laboratory Science Degree from di University of Development Studies and MBA from di Accra Business School.
Currently, e be di Ashanti Regional Secretary of di National Democratic Congress.
James Gunu – Volta Region
James Gunu na di regional nominee for di Volta region. E be ogbonge media practitioner.
E hold Bachelor of Arts in Journalism, Master of Arts in Development Communication and Masters of Arts in Lcal Government Administration and Organization.
Oga Gunu na di former MCE for Akatsi.
Rita Akosua Awatey – Eastern Region
She be woman wey get plenty experience on governance, education, and community development.
She get MPhil in Leadership from di University of Professional Studies, Accra.
She get correct track record as local governance practitioner, afta she don serve as presiding member of di Yilo Krobo Municipal Assembly and Deputy Eastern Regional Women Organiser of di NDC.
She be seasoned educator and advocate for women empowerment. Currently, she dey pursue PhD in Migration for di University of Ghana.
John Kwadwo Gyapong – Oti Region
Oga John na business executive and former Member of Parliament for di Akan constituency.
Currently, e be di NDC regional chairmo for di Oti region.
E get Bsc in Education from di University of Cape Coast.
Akamuguri Atanga – Upper East Regional
Atanga, di ministerial nominee for Upper East region hold Masters degree in Human Rights and Bsc. In Social Studies and Mathematics from di University of Education Winneba.
Bifor di nomination, e bin serve as coordinator of di National School Feeding Programme and presiding member of Bongo District Assembly.
Ali Adolf John – Northern Region
Di educational professional don serve as teacher, circuit supervisor and desk officer within di Ghana Education Service structure.
Di regional ministerial nominee get Bachelor of Education and Masters in Technology from di University of Education, Winneba.
Currently, e be di Northern Regional Chairman of di NDC.
Madam Charity Gardiner – Ahafo Region
Madam Gardiner na businesswoman and Human Resource professional wit close to 10 years of experience.
She get strong credentials for non-profit, humanitarian work, wit special interest in girl child education and empowerment.
She get Masters and Bachelor degrees in Human Resources Management.
Salisu Be-Awuribe – Savannah Region
Oga Be-Awuribe, di regional ministerial nominee for Savannah region na man of many hats. E be lecturer in Law, lawyer, valuation professional and development expert.
E don serve as district Chief Executive for di Central Gonja District.
E hold professional certificate in Law from di Ghana School of Law, Masters in Law from di University of Ghana, B.sc in Land Economy from di Kwame Nkrumah University of Science and Technology.
Hon. Linda Ocloo – Greater Accra Region
Madam Ocloo na member of parliament wey dey represent di Shai-Osudoku constituency.
She hold B.sc in Administration (Banking and Finance option) from di University of Ghana.
Ibrahim Tia – North-East Region
Oga Tia na public health finance and local goment professional wit expertise in systems, management, public relations and health financing.
Di regional minister nominee get ogbonge experience, wey include im work wit di National Health Insurance Scheme, wia e rise from di position of district manager to deputy regional manager for di Northern Regional Office of di NHIA.
E hold B.sc degree in Information and Communication Technology, Post Graduate Diploma in Management Studies plus mini MBA in Project Management.
Oga Tia don serve as di regional secretary of di NDC for di North East region since 2019.
According to Ghana constitutional provisions, di Speaker of Parliament must approve ministerial appointments bifor dem swear dem into office.
Di house go carry out background checks and parliamentary vetting to ensure say di nominees dey suitable for di roles.